Di Gambia

From Wikipedia

The Gambia na kontri wey dem dey kol Republic of Gambia. Dem stil sabi di kontri as Gambia. Na kontri wey dey West Africa. Na Senegal sorand am. Na im bi di kontri wey smal pas for mainland Africa. Na Banjul bi di kapita citi. Di city dem wey big pas na Serekunda and Brikama.

How di kontri bi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di kontri no bi like oda kontri. E dey long and tin. Apat from side wey dey for sea, na Senegal sorand am. Di Riva Gambia dey flo from Senega tru e senta and e enta Atlantic Ocean.

Weda[chenj-am | chenj-am for orijin]

The Gambia get weda wey dem dey call tropical climate. E dey get hot seaon and rain rain season wey dey last from June go rish November.

Politis and govment[chenj-am | chenj-am for orijin]

The Gambia get fridom from United Kingdom for 18 February 1965. Na Dawda Jawara and im People's Progressive Party (PPP) rul am from 1965 go rish 1994. For 1996, Yahya Jammeh bikom presido. For 2016, dem make Adama Barrow di presido.

Administrative divisions[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem divide vThe Gambia to 8 local govment aria. Dem bi:

  • Banjul
  • Kanifing
  • Brikama
  • Mansa Konko
  • Kerewan
  • Kuntaur
  • Janjanbureh
  • Basse

For 2013, dem divide dis aria dem to 43 districts.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]