Jump to content

Orji Uzor Kalu

From Wikipedia
Orji Uzor Kalu
pesin
Part ofNigerian senators of the 9th National Assembly Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejOrji Uzor Kalu Chenj-am
Orijina nemOrji Uzor Kalu Chenj-am
Fest nemOrji Chenj-am
Famili nemKalu Chenj-am
Wen dem bon am21 April 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbia State Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, businessperson Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Abia State, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulHarvard Business School, University of Maiduguri, Government College Umuahia Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party, All Progressives Congress Chenj-am
E pipulIgbo pipul Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Afta amAnthony Obi Chenj-am
Replaced byTheodore Ahamefule Orji Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Orji Uzor Kalu (dem bon am on 21 April 1960) na Naija politishan an biznesman wey bi di senate wey stan for Abia North Senatorial District. E.don sarf as govnor of Abia Stet fom 29 May 1999 rish 29 May 2007. Na Kalu bi di chairman of SLOK Holding an di Daily Sun an New Telegraph niuspepa in Nigeria. Bifor di eleshon, na im dey sarf as di chairman of di Borno Water Board an di chairman of dI Cooperative an Commerce Bank Limited. Kalu na bifor bifor People's Demokratic Parti (PDP), Progressive People's Alliance ( PPA), memba an di chairman of di PPA Board of Trustees. E dey insaid pipu wey go for Presidenshal eleshon insaid April 2007 general eleshon. Na All Progressives Congress (APC) parti e dey nau.

How e stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Kalu insaid Mr. Johnson Uzor Neseigbe Kalu an Mrs Eunice Kalu family. Wit onli $35 dolla wey e borrow fom im mama, Kalu stat to dey sel palm oil, fest e go buy am fom Nigeria's eastern region kon go sel am to northern region. E stat to dey sel tins wey dem du uze mek hauz fain smol smol. Kalu stat SLOK Holding, na kompini wey dey get som oda kompini insaid am, lik; Ojialex Furniture Company, SLOK Nigeria Limited, SLOK United Kingdom Limited, Adamawa Publishers Limited, SLOK Vegetable Oil, Aba, SLOK Paper Factory, Aba, SLOK United States Incorporated, SLOK Ghana, Togo, Cotonou, Guinea, South Africa, Liberia, Botswana, SLOK Korea, Supreme Oil Limited, SLOK Airlines, Sun Publishing Limited, and First International Bank Limited. Na Kalu age smol pas wen e kolet Nashonal Merit Awod fom President Ibrahim Babaginda, e dey 26 years dat taim in year 1986. E dey insaid Nigerian Chamber of Commerce Industrialist of di year, an dem giv am Awod of Humanitarian Awod of di University of Nigeria, Nsukka's Humanitarian Klub, di Volunteer Awod of di Internashonal Association of Volunteers, di Nashonal Merit Awod, di EU Speshial Awod in Brussels, an di Wod Bank Leon Sullivan Awod.

E go Christ d King Skul Aba an Govmet College Umuahia. Afta e stodi for Barewa College, Zaria, e go Universiti of Maiduguri wia e go stodi politika science. Kalu get digre fom Abia Stet Universiti, Certifikate in Biznes Adminstrashon fom Havard Universiti an honorary doctorate fom di Universiti of Maiduguri an Abia Stet.

  • 1999: Na im bi di bifor bifor elected Govnor of Abia Stet onda People's Democratic Party (PDP).[1]
  • 2003: E enta sekond taim as Govnor.[1]
  • 2006: E komot for People's Democratic Party (PDP) an go stat Progressive People's Alliance (PPA).[1]
  • 2007: E trai enta as di President of Nigeria onda PPA platform.[1]
  • 2007: E get case wit dem Economic and Financial Crimes Commission (EFFC) in 2007.[1]
  • 2011: E trai enta as di Abia North Senatorial candidate onda PPA platfom.[1]
  • 2012: E join di Peoples Democratic Party (PDP) bak.[1]
  • 2015: E leta go bak to Progressive People's Alliance (PPA) to kom out for Senatorial Eleshon.[1]
  • 2016: Di Supreme court rule set mek e go du trial, afta nine years e du case wit EFCC.[1]
  • 2016:E join di All Progressives Congress (APC) political party.[1]
  • 2018: Dem giv am Title: Danbaiwan-Hausa (Gifted Son of Hausa kingdom) by the Emir of Daura in President Muhammadu Buhari's town.[1]
  • 2019: E trai enta for the Abia State Senator an e win.[1]
  • 2019: E go jail 12 years bikos e duoni enihau in December 2019.[1]
  • 2020: Dem rilis am for jail afta Supreme.Court sey dem no du di case wel mek dem du am.again.[1]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. 1.00 1.01 1.02 1.03 1.04 1.05 1.06 1.07 1.08 1.09 1.10 1.11 1.12 1.13 {{Cite web|date=2019-12-06|title=TIMELINE: Orji Kalu's travails from Abia govt house to prison|url=https://www.premiumtimesng.com/news/headlines/366837-timeline-orji-kalus-travails-from-abia-govt-house-to-prison.html%7Caccess-date=2021-06-24