Jump to content

Omah Lay

From Wikipedia
Omah Lay
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemStanley Chenj-am
Famili nemDidia Chenj-am
AliasOmah Lay Chenj-am
Wen dem bon am19 May 1997 Chenj-am
Ples wey dem bon amPort Harcourt Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinga, pesin wey dey rait song, record producer, rapper Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Port Harcourt Chenj-am
Wen e stat wok2019 Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Stai of song abi fimAfrobeat, Afrobeats, contemporary R&B Chenj-am
Record labelWarner Music Group Chenj-am

Stanley Omah Didia (dem bon am for 19 May 1997), wey pipul sabi wel wel as Omah Lay, na Naija singa, song raita an Produsa. Pipul sabi am wel fo im song "Bad Influence" wey e du for year 2020. Meni pipul sabi am for di song wey Masterkraft du wit am an Alpha P, di song na remix for Justin Bieber 2021 "Peaches", anoda song wey som pipul sabi am wit na "Attention" wey dem rilis 2022. Na Omah Lay win di Next rated awod fo 2020 Headies Awods.

Hau e tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Stanley Omah Didia on 19 May 1997 for inside Port Harcourt. Na fom Ikwerre Lokal Govment inside Rivers State. E go Comprehensive High Skul insaid Rivers State, E kon leta go University of Port Harcourt. E kom fom famili wey lik musik, im granpapa dey pley musik instruments fo singa Celestine Chukwu bifor e die fo 1977. Na Lay's Papa dey pley di drums.

Hau e tek du im wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lay stat im karier wit rap group, im nem na "Lil King" for di grup. E com leta dey writ song an dey produs musik. E rilis "Do not Disturb" in April 2019. E rilis "Hello Brother" afta one month wey e don rilis di first song.

E du kontrat wit KeyQaad rekod Label inside June 2019, bifor e kom rest for seven month. Wen e dey res, e dey wok on im EP, Get Layd. E tel OkayAfrika sey, Na sins August[of 2019] e don dey wok. E tok sey e no dey too uze im fone, no dey du wetin e dey du bifor so dat im go fes di projects wey e dey du wel. E tok sey di first song wey e rekod for di Layd project na 'Bad Influence'. Afta di rest, e rilis 'Bad Influence', wey dey inside song wey pipul see pas for Naijà Apple Music for inside 2020.

For February 2020, Lay rilis "You", wey bi im first single. E rilis im five trak EP, Get Layd on 22 May 2020. Di EP dey Nomba 1 for Naijà Apple Music Charts. Na all di five songs for di EP dey for top 15 fo Apple Music Chart for Naijà an na You dey fo nomba one.

For October, Lay dey for Olamide's album Carpe Diem, for di trak "Infinity", wey dey for top on Apple Music Chart fo Naijà.

On 20 November, Lay rilis im sekond five trak EP, What Have We Done. All di five trak EP riich di top 12 fo di Apple Musik Chart for Naijà, wit "Godly" wey dey nomba one.

For 3 July 2020, na Lay bi di first singa wey Apple kol to dey hep dem disease niu singa for Afrika. Inside December 2020, e dey fo BBC Radio 1Xtra's Hot 2021, na im bi di first Afrika singa for Audiomack's #Up Now wey dem du for niu singas. E dey fo Montreux Jazz festival's wey dey fo 20 singa pipul dey lik ci for 2021. Dem im win di BET's Amplified singa for di month of November 2020. Na Dvpper Music wey dey Naijà im sign for now, an kon stil sign fo Sire rekod fo im wok wey dey go outsaid Naijà. Im nem dey amog Singa wey fit win four Awods fo 2020 Headies, na im win di Next Rated Awod.

For June 25 2021, Lay dey folo sing for Naijà produsa Masterkraft song, "Peaches" remix of Justin Bieber. Na 8 July 2021, Lay rilis niu song, "Understand". On 3 March 2022, e rilis song wey e du wit Justin Bieber, "Attention", wey mek am bi di sekond song wey dem du togeda.

On 14 December 2020, dem aress Lay an Tems fo Uganda. Di Uganda polis tok sey dey no folo Covid-19 law fo dia kontri. Di singa no gree wit dem bicos dey tok sey na pesin arenj dia aress. Afta two days Uganda polis rilis dem, kon stil beg dem.

Lay tok sey e dey sopot di #EndSARS campaign fo Naijà. E tel Harper's Bazaar, pipul sopos no sey di EndSARS na abaut Naijà pipul, no bi fo politis. Polis dey kill, beat pipul an dey du as dem lik. E stil tel dem sey mek Govment du somtin fo di mata.

Studio Albums

[chenj-am | chenj-am for orijin]
TitleAlbum details
Boy Alone.Schedule Spring 2022

.Label: Sire, KeyQaad .Format: Digtal download, streaming

Extended Play

[chenj-am | chenj-am for orijin]
TitleExtended Play details
Get LaydRilis: 22 May 2020

.Label:Sire, KeyQaad .Format: Digital download, streaming

What Have We DoneRilis: 20 November 2020

.Label: Sire, KeyQaad .Format: Digital download, streaming

As lead artist

[chenj-am | chenj-am for orijin]
TitleYearAlbum
"Do not disturb"2019Non album rilis
"Bad Influence"2020Get Layd
"Damnn"2020Get Layd
"Forever" Remix (wit Gyakie)2021Non album rilis
"Understand"2021Boy Alone
"Free my mind"2021Boy Alone
"Winter Wonderland / Don't Worry Be Happy"2021Non album single
"Attention" (wit Justin Bieber)2022Boy Alone

As Feature Artist

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Singles wey e sing wit klasifikation
TitleYearAlbum
Tonight (Spinal ft Omah Lay)2020Grace
"Pami" (DJ Tunez featuring Wizkid, Adekunle Gold an Omah Lay)2020Non - album single
"Pronto" (Ajeb Huslers featuring Omah Lay2021Kpos Lifestyle, Vol 1
"Peaches" (Masterkraft remix)2021Non album single

Guest Appearances

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Artist wey E sho as featuring artist an di year dey rilis di album
TitleYearOda ArtistAlbum
"Infinity"2020OlamideCarpe Diem
"Abeg"2021Dj Neptune, JoeboyGreatness 2.0

Produsa wey e wok wit

[chenj-am | chenj-am for orijin]

2018

Kidoben Ace

."Caught up"

2019

Klug Ali

."Opium" 

Skiboi

."One Day"

2020 Omah Lay - Get Layd

.2."Lo Lo"
.4."Bad Influence"

Moveek

."Flossin"

Omah Lay- What Have We Done

.4."Confession"

2021

Jhay Jhay
 ."Welcum Party"

Awods an Normination

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Year Awods Katigori Norminee/Wok Results
2020 Di Headies 2020|The Headies Next Rated Omah Lay won
Viewer's Choice nominated
Best R&B Single "Bad Influence" nominated
Songwriter of the Year Stanley Omah Didia – "Bad Influence" nominated
2021 Ghana Music Awod Best African Artiste of the Year Omah Lay TBA1
MTV Africa Music Awards Best Breakthrough Act pending
Net Honours Most Played Pop Song ''Godly" won
Most Played RnB Song "Pami"

(DJ Tunez featuring Wizkid Adekunle Gold & Omah Lay)

nominated
All Africa Music Awards|All Africa Music Awards (AFRIMA) Artiste of the Year in Africa Omah Lay nominated
Best Artiste in Western Africa nominated
Breakout Artiste of the Year nominated
Best Artiste, Duo or Group in African Pop nominated
2021 Afro X Digitals Awods Breakout Act of di year Omah Lay win

Wia wi gada di tori fom

[chenj-am | chenj-am for orijin]