Okezie Ikpeazu
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Okezie Victor Ikpeazu |
Orijina nem | Okezie Victor Ikpeazu |
Fest nem | Victor |
Famili nem | Okezie |
Wen dem bon am | 18 October 1964 |
Ples wey dem bon am | Abia State |
Pesin wey e mari | Nkechi Ikpeazu |
Fest langwej | Igbo langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej, Naijá langwej |
Langwej wey e tek rait di wok | English langwej |
Wok wey e dey du | politician |
Post wey e dey | Governor of Abia State |
Wie e go skul | University of Maiduguri, University of Calabar |
Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party |
E pipul | Igbo pipul |
Rilijon | Catholicism |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Medical condition | COVID-19 |
Personal pronoun | L485 |
Okezie Victor Ikpeazu (dem bon am on 18 October 1964) na Naija politishan an forma Govnor of Abia Stet, wey dey ofis fom 29 May 2015 to 29 May 2023. Na onda People's Demokratic Parti e tek kom out. Na im enta for sekond taim as Govnor of Abia Stet on 9 March 2019 gubernashonal eleshon. E trai enta as 2023 Senatorial eleshon for Abia Sauth Senatorial District but e no enta.
How e tek stat life an edukashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Okezie on 18 October 1964, insaid late Pa Ismael an Diocese Bessie Ikpeazu wey kom fom Umuebere in Umuobiakwa vilej, Isialaukwu, Mbato one Kommuniti in Obingwa Lkcal Govmet Aria of Abia Stet, Nigeria. Ikpeazu go Amiase Centra Primari Skul, Umuobiakwa. Insaid 1973, wen e dey primari five, e go Eziama High Skul, Aba kon leta muv go Ihie High Skul, Isiala Ngwa wia e tek du im Skul Certifikate examinashon in 1979. In1980, Wen e dey 16, e go Universiti of Maiduguri go stodi Clinical Biochemistry an finish wit B.sc. (Hons.) Sekond Klass Upper divishon in August, 1984.
Im pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ikpeazu na memba of Seventh Day Adventist Chorch, e get four pikin wit im waif.