Laycon

From Wikipedia
Laycon
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemOlamilekan Massoud Al-Khalifah Agbeleshebioba Chenj-am
Fest nemQ46997169 Chenj-am
AliasLaycon Chenj-am
Wen dem bon am8 November 1993 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey durapper, singa, musician, media personality, reality television participant Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, University of Portsmouth Chenj-am
Wen e stat wok2016 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Instrumentvoice, guitar Chenj-am
Indigenous toOgun State Chenj-am
Stai of song abi fimrapping, pop rap, Afrobeats, hip hop music Chenj-am
Record labelFierce Nation Chenj-am
Significant eventBig Brother Naija, season 5 Chenj-am
Official websitehttps://itslaycon.com/ Chenj-am

Olamilekan Massoud Al-Khalifah Agbeleshebioba (dey bon am 8 November 1993) wey pipo no wel wel as Laycon na Naija rapa, singa, song-raita, an e dey sho for T.V program. Na Laycon win di Big Broda Naija Sisin 5. Laycon bi di young pipo habaserdo for Ogun Stet. Na Laycon win di 2020 Artist of di year for di 2020 Naijatraffic Awards

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos, Naija dey bon Laycon on 8 November 1993. Laycon gra-papa dem kom from Baluwen, Odeda, Ogun Stet. Laycon go Legos Stet Model Kolej merian from 2003 go rish 2009. Laycon enta Yunivasiti of Legos in 2012 an e finish in 2016. Na Filosofi e go rid for di Yunivasiti. E finish with Sekod klass uppa digree.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Laycon fest go gada nolej as e wok as P.A ( pasonal hasista) to di MD an CEO of Latjum Global Nigeria Limited. E start to do di wok wen e stil de Yunivasiti. Wen e finish skul, Laycon go wok for Bestman Games wey de Ikoyi, Legos. E dey helep as dia sale workas. Two month afta we start di wok, Laycon komot go bi di P.A to hasitat daretor of Welfare in administrashon an human risosis for Legos Stet Ministri of Informashon an Strateji.

Laycon dey rait for free for difren kompini.

On 6 October 2020, Laycon bikom di young pipo habaserdor for Ogun Stet. Na Govno of Ogun Stet, Dapo Abiodun chuz am.

On 3 January 2021, Laycon risiv one tradishonal tahitu from di king of Ipokia, Yisa Adesola Olaniyan. Di tradishonal tahitu na: Akeweje of Ipokia Kingdom, Ogun Stet. Na for Opo Day selibreshon wey dem do in 2021 e tek kolet di tahitu.

How e tek do muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Laycon stil smol, e don dey rait muzik an dey sing. For 2014, Laycon folo join for di 10 muzishan wey folo sing for di 2014 Coke Studio Yunivasiti of Legos show. Laycon join for di top ten singa wey stil rimen for di 2017 MTV Base LSB shalenj. Olugbenga Jackson rekod lebel "Fierce Nation" sahin Laycon in 2019. Laycon on 21 February 2019 rilis one muzik kol "Fierce" wey kom leta de inside e sekod habom kol: "Who is Laycon "?. For di Fierce song, Chinko Ekun an Reminisce folo sing inside. Laycon rilis anoda song "Senseless" on 28 August 2020.

Rekod-dem for muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Mixed tapes
  • Any Given Monday (The Playlist) (2019)
  • Any Given Monday II (2019)

EPs[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Young Black and Gifted (2016)
  • Who is Laycon? (2020)

Habom[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Shall We Begin (2021)
  • I am Laycon (The Original Soundtrack) (2021)

Singu[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Fierce (2019)
  • Senseless (2020)
  • HipHop (2020)
  • Fall for me (2021)
  • Wagwan (2021)
  • New Dimension (2022)
  • 2000 (2022)

Filmography[chenj-am | chenj-am for orijin]

Television[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Tahitu wetin e do Notes
2020 Big Brother season 5 Himself Rihaliti show
2021 I Am Laycon Himself Showmax original which premiered on 11 February 2021

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Awod serimoni Awod description(s) Recipient Results Ref
2020 City People Music Awards Special Recognition Award Himself Won
African Entertainment Awards USA Best New Artist Won title=Sauti
Naijatraffic Awards Artist Of The Year Won
Naijatraffic Awards EP/Album Of The Year "Who Is Laycon" Won
2021 Net Honours Most Popular BBNaija Star Himself Nominated

Big Broda Naija Sisin 5[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Laycon bi di nomba 19 pesin wey enta di Big Broda Naija Sisin 5 on 19 July 2020. Pipo like am no bi smol. Laycon bikom di fest pesin wey go get 1 million folowas on Instagram wen e stil dey inside di buildin on 19 September 2020.

Wen dey wan tok di risot of di sisin 5, Laycon win 65% of di vote an e go house with 85 million moni wey de for pesin wey kari fest