Jump to content

Dapo Abiodun

From Wikipedia
Dapo Abiodun

Dapo Abiodun (dem bon am for May 29, 1960) na Naija politishian an biznessman. Dapo Abiodun bi di Gofnor of Ogun Stet afta wey e win di eleshon for 2019 onda di parti All Progressive Congress (APC). Di man bi di oga pata pata for one govament oganasashion wey dey rejista nem of kompini an biznes wey govament alao to dey wok. Di nem of di Organasashion na Corporate Affairs Commission (CAC). Bifor Dapo Abiodun enta as gofnor of Ogun Stet, e bi di Maneji Daretor (M.D) of one petirol kompini wey di nem na Heydey petroleum an also e bi di pesin wey fest stat one kompini wey get di nem First Power Limited. For March 10 2019, di grup wey dey kotro eleshon for Naija wey di nem na Independent National Electoral Commission (INEC) tok sey Dapo Abiodun go bi di nes gofnor of Ogun Stet.

Tori of e life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Dapo Abiodun for May 29, 1960 for Iperu Remo inside Ikenne lokal govament for Ogun stet.Dapo kom from di famili wey dia papa papa dem bi king in Iperu.Dapo bi di pikin of Dr Emmanuel Abiodun an im mama bi Victoria Abiodun wey kom from Iperu Remo inside Ogun East wey bi one of di aria wey sineto dey kom from in Ogun Stet.

Tori about im skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di koret tori of how Abiodun tek go skul no too klear. Im bi enta wan palava wen e rimen smol for di 2015 senatorial eleshon wen e tek for di pepa wen e wan tek do eleshon. Di pepa tok sey e go rid buk for Obafemi Awolowo Yunivasiti, bot wen i wan go for govnor election in 2019, Dapo tak se na onli sekondiri skul i finish an se na di satifikat de i hand.

Tori of how e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dapo Abiodun bi di owna an Oga for one kompini wey get di nem Heydey Petroleum Limited (HPL). Im bi also di pesin we fest stat di kompini wey di nem na First Power Limited.

How e tek wok for politis

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dapo Abiodun bi one of di pipul wey kari di parti People Democratic Party (PDP) kom Ogun Stet, bot for now i don join anoda parti we i name bi All progressive Congress (APC) wen i no win di election wey hapun for 2015. Abiodun onda di parti APC join odas kadidate tek fight for one position for govment wey den name Ogun East gubernatorial election but na the pesin wey People Democratic party carri kom win the election. Abiodun befo befo don bi sinato for Naijá onda wan pati we no dey again in 1998.Di name of di party na United Nigeria Congress Party (UNCP). Naijá Govment don use Abiodun fo mani manibgroup and oganasashion. For 2019, e use di party All Progressive Congress (APC) tek fight for the position for gofnor and de pick am as governor. For 29 of May 2019, dey give am pawa to bi di Gofnor of Ogun Stet. Abiodun na confam kristian and i de go di church we i name na Mountain of Fire and Miracle Ministry.Abiodun tak se na God win becos bad bele pipul no wan make i bi gofnor of Ogun Stet.

Fo 2018, wan newspepa we i name na Cable Newspape tak se Abiodun use wayo tek get pape se i don pass out for school.

Im personal laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dapo Abiodun bi di hosband of Bamidele Abiodun an dey get five pikin togeda.