Godswill Akpabio

From Wikipedia
Godswill Akpabio
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejGodswill Akpabio Chenj-am
Wen dem bon am19 December 1962 Chenj-am
Pesin wey e mariEkaette Unoma Akpabio Chenj-am
Fest langwejEfik language Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Efik language, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Akwa Ibom State, member of the Senate of Nigeria, Minister of Niger Delta, President of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Calabar, Nigerian Law School, Government College Umuahia Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress, All Progressives Congress Chenj-am
E pipulCalabar people Chenj-am

Godswill Obot Akpabio CON (dey bon am 9 December 1962) na Naija lorya an politishan. akpabio bi di koret Sineti presidet of Naija. E don bi di minista for Niger Delta Affair from 2019 go rish 2022. Akpabio don bi di govno of Akwa Ibom Stet from 2007 go rish 2015.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Godswill Obot Akpabio on 9 December 1962. E papa nem na Obot Akpabio an e mama nem na Lucy Obot Akpabio ( e mama nem bofor e mari na Inyangetor). Akpabio mama kom from Ukana, Ikot Ntuen in Essiem Udim Lokal Govamet Aria. Wen Akpabio stil dey smol, e papa kpai. Na Akpabio mama train am.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akpabio go Methodist Pamari Skul, Ukana, Essien Udim LGA, Akwa Ibom Stet. For e sekondiri skul edukeshon, Akpabio go Fediral Govamet Kolej Pot Hakot, Riva Stet. For e Yunivasiti edukeshon, Akpabio go Yunivasiti of Kalabar, Kross Riva Stet. From di Yunivasiti, e rid Law. Wen Akpabio de sekondiri skul, dey mek am di Senior boy of di skul. Wen Akpabio de Yunivasiti, dey mek am di spika of di house.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akpabio granpa, Okuku Udo Akpabio bi di shif Polis ofisa in Ikot Ekpene aria wen e de alive. Akpabio onku Dr.I.U. Akpabio bi di Minista of Edukeshon/Intanal Hafihas for di Easta Naija dat time. Justice Nsima Akpabio, wey bi Akpabio korsin bi sineto in di Sekod Naija Riploblik. Akpabio na kristen an na Katolik Chorch e dey go. Akpabio wife na Ekaette Unoma Akpabio. Akpabio wife bi di fonda of FLEI (Famili Life Enhasmet Initiative), one hoganaseshon wey dey helep famili-dem to fit live well. Na five pikin Akpabio an e wife get; four boys an one girl.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akpabio do smol tisha wok bifor e wok for Paul Usoro and Co., one law kompini wey de Naija.

Akpabio don also wok for EMIS Telikom Limited, One telifone kompini wey de Legos. In 2002, dey mek Akpabio CEO of di Kompini. Akpabio don bi di Seketiri of ATCOM ( Assosiashon of Telikommunikashon Kompini in Naija]] wen e dey wok as CEO of EMIS.

E wok with govamet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2002

Govno Obong Victor Attah of Akwa Ibom chuz Akpabio as di kommishonal for Petrolium an Nashoral Risosis. Bitwin 2002 to 2006, na three aria of the ministri, Akpabio kontro:

  • Ministri of Petrolium an Nashoral gas
  • Ministri of Lokal Govamet an Shiftansi Affairs
  • Ministri of Lands an Housin.
  • 2006

Akpabio win di pamari eleshon wey PDP Pipo Demokrasi Parti to bi dia govno kandidet for Akwa Ibom.

  • 2007

Akpabio win di eleshon to bi di govno of Akwa Ibom. Akwa Ibom win di sekod term eleshon to kontiniu to bi di govno of Akwa Ibom for di sekod time.

  • 2013

Dey pik Akpabio to bi di chairman of PDP Govno Hasembili

  • 2015

Akpabio win di eleshon to bi di Sineti of di Akwa Ibom North-West Senatorial District, (Ikot Ekpene)

  • 2018

Akpabio risain as di lida of Sinetor Minoriti Lida bikos e komot from PDP enta APC.

  • 2019

Forma presidor Muhammadu Buhari chuz Akpabio to bi di Minista for Niger Delta Affairs.

  • 2022

Akpabio risain as di Minista for Niger Delta Affairs bikos e wan go for presidet of Naija onda di APC parti. Akpabio gree mek APC chuz Bola Tinubu as dia kandidet. Akpabio win di pamari eleshon wey APC do for pipo wen wan go for Akwa Ibom North-West Senatorial District

  • 2023

Akpabio win di PDP kandidet Emmanuel Enoidem to bi di sineti of Akwa Ibom North-West Senatorial District. Na 115, 401 vote Akpabio get. Emmanuel Enoidem get 69,838 vote. On 13 June 2023, Akpabio bikom di sineti presidet of Fediral Ripoblik of Naija.

Korupshon kases[chenj-am | chenj-am for orijin]

EFCC (Economic and Financial Crime Commission|Ekonomik an Finanshial Krime Kommishon]] hakuss Akpabio sey e chop 100 billion wen e bi di govno of Akwa Ibom Stet from 2007 go rish 2015. But di kases no gree enta kot mek joj-dem luk into am.