Gbenga Daniel

From Wikipedia
Gbenga Daniel
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemGbenga Chenj-am
Famili nemDaniel Chenj-am
Wen dem bon am6 April 1956 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duengineer, politician, profeso Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Ogun State, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, Baptist Boys’ High School Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party, All Progressives Congress Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Gbenga Daniel (dey bon am 6 April 1956) na Naija politishan wey bi Sinetor for Ogun East sins 2023. Na Daniel bi di go no of Ogun Stet from 2003 go rish 2011. Gbenga Daniel get one kompini Kresta Laurel wey e start in 1990. Di kompini na one mekanika enjineerin kompini. Na Gbenga Daniel stil dey kontro Conference Hotels. Di hotel get plenti branch for Ijebu-Ode, Sagamu, Abeokuta an Isheri pat of Legos. Wen Gbenga Dsniel stil bi govno of Ogun Stet, e join bodi with pipo wey dey du bizness to wok togeda an dis one mek meni bizness kompini kom to Ogun Stet.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ibadan, Oyo Stet dey bon Gbenga Daniel on 6 April 1956. E papa nem na Adebola Daniel an e mama nem na Olaitan Daniel. Gbenga Daniel papa kom from Sagamu an e na pasto for Church of the Lord (Aladura). Gbenga Daniel mama kom from Omu-Ijebu an e dey sel tins as treda.

Gbenga Daniel go Baptist Boy Hi Skul, Abeokuta from 1969 go rish 1973. For di skul, na Gbenga Daniel dey go if dey wan do dibet an kompetishon dis one mek am popula for di skul. Wen Gbenga Daniel finish Baptist Hi Skul, e enta The Polyteknik, Ibadan go rid Basic Studies for e Advanced Level (A' Level). Gbenga Daniel leta enta Yunivasiti of Legos to go stodi enjineerin. Gbenga Daniel no buk wel wel as dey give am free edukeshon . Pipo for skul no Gbenga Daniel as one of di best studet of Prof. Ayodele Awojobi. Wen Gbenga Daniel stil bi studet for Yunivasiti, e join one komitee wey dey sopot Obafemi Awolowo. For dat Komitee, na Gbenga Daniel smol pass for Age. Leta, di Komitee leta bikom di Unity Party of Nigeria (UPN).

Na Prof. Ayodele Awojobi mek Gbenga Daniel like to go stodi Enjineerin for skul. Gbenga Daniel sabi buk nobi smol bikos na im dey win pass for di televishon show "Mastermind".