Emeka Ihedioha

From Wikipedia
Emeka Ihedioha
pesin
Part ofHouse of Representatives of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejEmeka Ihedioha Chenj-am
Famili nemIhedioha Chenj-am
Wen dem bon am24 March 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amOwerri Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Imo State, member of the House of Representatives of Nigeria, member of the House of Representatives of Nigeria, member of the House of Representatives of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
Wie e dey livImo State Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
E pipulIgbo pipul Chenj-am

Chukwuemeka Ihedioha (dem bon am 24 March 1965) na Naija politishan wey don do govnor of Imo Stet from 2019 go rish 2020. Supreme Kot of Nigeria komot am as di govno of Imo Stet on 14 January 2020. Di kot kom tok sey na Hope Uzodima wey bi APC kandidet bi di orijinal winna of di 2019 eleshon. Ihedioha na bifor bifor deputi spika of House of Representativ of Nigeria from 2011 go rish 2015.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Chukwuemeka Ihedioha on 24 March 1965 for Mbutu in Aboh Mbaise lokal govamet aria for Imo Stet. Ihedioha go Town School Mbatu wey de Aboh Mbaise but na for SDA pamari skul wey de Abule Oja in Yaba Legos Stet e tek finish e pamari edukeshon. Ihedioha do e sekondri skul edukeshon at St Ephraim Sekondri Skul in Owerrinta for Abia Stet. Afta Ihedioha finish sekondri skul, e enta Yunivasiti of Legos to go rid Fud Sayens an Tekinoloji. Ihedioha in 1988 kolet e B.Sc digri from Yunivasiti of Legos. Ihedioha go do one ezekutiv korse on finashial manejimet in Stanford Yunivasiti. E stil do one lidaship korse for Harvard Kennedy School of Government in Havard Yunivasiti.

How e tek work for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1992, dem pik Ihedioha to bi di Press Ofisa to di Sineti Presidet of di Fediral Riploblik of Nigeria dorin di time of Shif Iyorchia Ayu. Iyorchia Ayu bi di Sineti Presidet at dat time. One year leta, Ihedioha bikom di shif press sekretiri to di Deputi Sineti Presidet. Wen militiri pipo kom enta Naija politis in November 1993, Ihedioha liv di politis karia an go bak to e work as Shif Ezekutiv Ofisa of First Page Communication. Wen dem form di niu politika parti PDP (Pipo Demokratik Parti in 1998, na Ihedioha bi dia Daretor of Poblisiti. For 1999, dem pik Ihedioha as Spesha Asistans to di Presidenshia Advaisa on Utilities. Na Ihedioha still work as Spesha Asistans on Mediha an poblisiti to di Sineti Presidet in November 1992. Di pesin wey still do Spesha Asistants on Poitika mata to di vais presidet in September 2001 na Ihedioha. E win di eleshon wey mek am di memba of House of Represetetiv from Aboh Mbaise-Ngor Okpala Fediral Konstitu-ensi of Imo Stet in 2003. Ihedioha do deputi spika of di House representetiv from 2011 go rish 2015 Wen Tambuwal bikom govnor of SokotosStet. Ihedioha kari post sey e wan yuz PDP parti tek kampain to bi di govnor of Imo Stet on 9 March 2019. INEC (Indipedet Nashonal Electoral Kommishon tok sey na Ihedioha win di eleshon. Ihedioha win di pesin wey kari sekod wey bi Uche Nwosu ( Nwosu na son-in law for di govnor wey dey kontro tins in Imo Stet for dat time). Na Action Alliance Party Nwosu tel kampain im disaya to bi di govnor of Imo Stet. Di tota of pipo wey vote for Ihedioha dat time na: 273, 404.

Supreme kot komot Ihedioha as govnor of Imo Stet on 14 January 2020.