Don Jazzy

From Wikipedia
Don Jazzy
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Orijina nemMichael Collins Ajereh Chenj-am
Fest nemMichael Chenj-am
AliasDon Jazzy Chenj-am
Wen dem bon am26 November 1982 Chenj-am
Ples wey dem bon amUmuahia Chenj-am
Fest langwejIsoko Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Ancestral homeDelta State, Naija Chenj-am
Wok wey e dey durecord producer, pesin wey dey rait song, musician, entrepreneur, philanthropist Chenj-am
Wie e go skulAmbrose Alli University Chenj-am
Wen e stat wok2002 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Owner ofMavin Records Chenj-am
Stai of song abi fimAfrobeat, African popular music Chenj-am
Record labelMo' Hits Records, Mavin Records Chenj-am
Awod wey e koletThe Headies, City People Entertainment Awards, Nigeria Entertainment Awards, The Headies, The Headies Chenj-am
Official websitehttps://mavinrecords.com/ Chenj-am

Micheal Collins Ajereh (born 26 November 1982), wey meni pipul sabi am as Don Jazzy, na rekod Produsa. Na im get Mavin Records. E dey insaid pipul wey stat Mo' Hints rekods wit D'bang.

Hau e tek stat life an Skol[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Umuahia, Abia State dem born Don Jazzy, im papa na Collins Enebeli Ajereh an im mama na Mrs Ajereh. Don Jazzy papa na fom Isoko wey dey Delta State an im mama na fom king famili for Abia State.

Na for Ajegunle, Legos e gro up. Don Jazzy go co- educational high school, Federal Government College Lagos. Don Jazzy don lik musik fom smol, wen e dey 12 years e don sabi pley piano an guitar. Don Jazzy kon stil go Ambrose Ali University, Ekpoma, Edo State go stodi business management.

For year 2000, Don Jazzy uncle hep am go London to go pley guitar for one London chorch. Don Jazzy wok for MacDonald wey dey for London. Don Jazzy stil dey du musik for London wit Solek, JJC Skillz, Kas, Jesse Jagz, 419 Squad an D'Banj. For March 2012, Don Jazzy an D'banj tok sey dem no dey togeda again.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Mo'Hits Rekods an GOOD music

Na year 2004 Don Jazzy an D'banj stat Mo'Hits Rekods. Afta 2 years dey kon stat di rekods, Don Jazzy produs No long thing an Rundown/Funk You up album.

Insaid 2008, Don jazzy produs The Entertainer wey D' Banj sing. Na im hep Wande Coal produs hol di Mushin 2 Mo'Hits album.

Insaid 2011 Don Jazzy folo Kanye West wok fo Very Good Music. Don Jazzy an Kanye West wok togeda produs Lift Off, wey Beyonce sef dey insaid di song.

Marvin Rekods

Na May 7 2012, Don Jazzy anous sey e don get new rekod label wey bi:Mavin Records. For May 8, 2012 Don Jazzy rilis album wey hol artists wey dey for di niu Marvin Rekods dey insaid. Mavin rekods sign Tiwa Savage wey pipul sabi wel wel.

For 5 November 2013, Ajereh an Wande Coal no gree fo diaself, wey mek Wande Coal leta komot for Mavin Rekods.

Insaid September 2014, Ajereh produs for Reekado an D'ija, Di song nem na "Arise".

For Headies Award 2015, Don Jazzy an Olamide no gree on top who win di Headies Next Rated awod. Olamide tok say na Lil Kesh sopos win am but dem giv Rekaado.

Insaid 2019, Don Jazzy sign Rema an for 2020 e kon sign Ayra Starr for Mavin Rekods. Insaid 2021 Don Jazzy anous niu artist wey bi Magixx.

Insaid fims wey e don sho[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid 2011, Don Jazzy dey insaid Moses Inwang's Nollywood fim The 3 Digits.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Nigerian Music Awards (2006) - Produsa of di year
  • Nigerian Entertainment Awards (2007) - Music Produsa of di year
  • The Headies 2011 - Produsa of di year
  • The Headies 2014 - Produsa of di year
  • City People Entertainment Awards (2015) - Special Recognition Awod
  • The Beats Awards TM(2019) - Niu Diskova Awods

Som Of di wok wey e produs [chenj-am | chenj-am for orijin]

Im pasonal Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Don Jazzy mari Michelle Jackson insaid 2003. Don Jazzy an im wife kon leta skata afta two years. E tok sey e no mari again bikos e too lik music.

Ajereh get broda, D'Prince wey dey du music sef.

Insaid July 2022, e tok sey im mama die for Instagram. Na cancer kill am.

Memba for Cheribum an Seraphim chorch[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pesin wet get Mavin Rekods, Don Jazzy tok sey e bi memba for Cheribum an Seraphim an na sins wen e dey smol e don dey go di chorch.