Rema

From Wikipedia

Divine Ikubor (dem bon am for May 1 2000), wey pipul sabi for im wok as Rema, na Naijà singa an rapa. Di song wey mek pipul sabi am wel wel na Iron Man, wey dey inside 2019 Barrack Obama bes song. Na 2019 im sign for Jonzing World rekod, wey dey for of Mavin rekod.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Divine Ikubor papa an mama na Christian famili fo Benin City. E don dey sing an rap sins e don dey sekondiri skol. Na Ighile grup of skol e tak finish im Primary an sekondiri skol fo Edo State.

Im Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo 2018 Rema sampu Dprince's Gucci Gang song fo Instagram. Na di sampu mak Dprince kol am kom Legos, mak im fo sign fo im rekod label. Rema sign fo Dprince Jonzing World, wey bi pat of Don jazzy Malvin rekod label, fo 2019. Rema rilis im smol album wey e kol am Rema fo 2019, wey dey numba 1 for Apple Music fo Naijà. Fo May 21 2001, Jonzing wod an Malvin rilis vidio fo Dumebi song, wey mak im smol album sel wel. Na Ademola Falomo du di vidio wey 50 million pipul ci fo Youtube.

Fo May 2021, Rema tok say im go dey kol im kain song Afrorave, wey bi pat of Afrobeat. Fo d wod pipul lik Rema song.

Fo September 2021 Rema nem dey fo singa wey go bi Pepsi Ambassador, na im an Ayra Starr nem dem kol.

Rave an Roses[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta Rema du kontrat wit Jonzing wod fo 2019 im rilis im smol album wey e kol Rema. E kon leta rilis im first album wey bi Rave an Roses fo March 25, 2022 Di album get 16 trak inside an som oda singa folo sing inside lik Chris Brown, 6lack, Aj Tracey and Ysuelt.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo 19 October 2019, Rema win Next Rated awod an im nem dey insaid pipul wey fit win fo viewers Choice awod for di 13th Headies. Na 12 January 2020 Rema win Soundcity MVP awods fo bes singa. Fo 15 June 2020, Rema nem dey fo singa wey fit win Best Viewers Choice: International Act fo 2020 BET awod. Na Rema, Wizkid an Burna Boy, bi di onli singa fo Naijà wey dem kol dia nem fo di awod.

Im Persona Lif[chenj-am | chenj-am for orijin]

klub wey Rema lik an dey sopot na Manchester United F.C. Fo 28 September 2020, Rema writ fo twitter say na People Democratic Party (PDP) no somtin how im papa Justice Ikubor, tak die. Fo semptember 2020, Rema song dey insaid di FIFA 21.

Im Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Album Rave & Roses - 25 March 2022

EXtended Play(EP)

.Rema - 2009

.Freestyle -2019

.Bad Commando - 2019

.Ravage - 2023

Singles

.Dumebi - 2019

.Why - 2019

.Corny - 2019

.Boulevard - 2019

.American Love - 2019

.Spiderman - 2019

.Trap Out Submarine - 2019

.Lady - 2019

.Rewind - 2019

.Spaceship Jocelyn - 2019

.Dumebi Remix - 2020

.Beamer - 2020

.Rainbow - 2020

.Fame - 2020

.Ginger me - 2020

.Alien - 2020

.Woman - 2020

.Peace Of Mind - 2020

.Bounce - 2021

.Soundgasm - 2021

.44 - 2021

.Calm Down - 2022

.FYN - 2022

AWODS
Year Awod Catigori
2019 The Headies Next Rated
2019 City People Music Awod Revelation of the year
2020 The future Awod Afrika Music