Wande Coal

From Wikipedia
Wande Coal
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am18 October 1985 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Island Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dusinger-songwriter Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
Wen e stat wok2006 Chenj-am
Stai of song abi fimAfrobeats, rhythm and blues Chenj-am
Official websitehttp://www.officialwandecoal.com Chenj-am

Oluwatobi Wande Ojosipe (bon 18 October 1985) wey plenti pipu sabi as Wande Coal, na Naijà singa.

How Im Tak Stat Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for 18 October 1985 for Lagos Island, Lagos State, Nigeria. Im papa an mama na Cheif Ibukun Olufunto an Omolara Oluwayemisi Ojosipe. Na im dem bon first fo famili.

Im Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wande Coal stat im skul for Staff Nursery and Primary school Ijanikin, Lagos kon stil go Federal Government College Ijanikin, Lagos. Na for Lagos State Nigera di skul dem dey. Afta dat one im kon go University of Lagos(Unilag), Lagos State.

Im Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wande Coal stat to dey sing wen im dey smal. Dem fest sabi as persin wey dey dance,bifor dey kon no am as singa. Na for Mo'Hits Records wey Don Jazzy get im first sign for an na year 2006.Im folo sing for Dbang album wey bi Rundown/Funk You up. Im own song for Mo'Hits Records na Ololufe. Pipu lik dat em song wel wel, plenti tok say na lof song wey swit pas. Afta im song e kon do im Album wey bi Mushin To Mo'Hits,wey pipu lik wel wel for Naijà, UK an for USA sef.

Coal don du plenti song wit difren Naijà singa, som of dem na Ikechukwu, Phyno, Vector, Davido, Naeto C, Dr Sid, an Wizkid. For 2012 wahala hapun for Mo'Hits wey mak Don jazzy an Dbang wey bi oga skata. Don Jazzy go do anoda rekod compini wey bi Mavins Record. Wande Coal kon folo Don Jazzy sign anoda rekod wey bi Mavins Records, no bi onli Wande Coal sign for Mavin Dprince an Tiwa Savage sef folo sign.Na November 7, 2013 Wande Coal komot for Mavin Records. Im du song wey bi Baby face for November 2013, na bikos of dat song im komot fo Mavin Records.

Wande Coal do im nomba 2 album afta som years. Na October 2015 e do anoda album, wey bi Wanted. Na anoda rekod wey bi Black Diamond im for du di album. For Decemba 2017 im sing anoda song wey pipul lik, di song nam na Turkey Nla. Im du anoda song for 2021 wey bi Come My Way.

Im Album[chenj-am | chenj-am for orijin]

.2009: Mushin To Mo'Hits

.2015: Wanted

.2020: Realms


Togeda Album .

.Curriculum vitae (2007)

.Solar Piexus (2012)

Pipul Im wok Fo[chenj-am | chenj-am for orijin]

.P-Lola - For You

.Ikechukwu- Like You

.Naeto C - Ashawo.

.Naeto C one for me

.Wizkid- One for me

.R2Bees- Kiss ur Hands

.Dbang- Celebrate

.D prince Ooze

.D Prince -Like what i see

. Patoranking- My woman

.Shizzi- Kosowo