Abibatu Mogaji

From Wikipedia

Abibatu Mogaji FCM, OON (dem bon am for October 16, 1916 an e kpai for June 15, 2013) na Naija biznes wuman an di lyaloja of Lagos.

How life tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Abibatu Mogaji for October 16, 1916 for Lagos koloni weyt dey for di south pat of Naija.

Tori abaut e famili[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shif Mogaji bi di mama of di National Leader of di All Progressive Congress (APC) an gofnor of Legos Stet one time wey e nem na shif Bola Tinubu.Shif Tinubu pikin wey bi gel wey e nem na Folashade an na Folashade tek ova fom di granma as di lyaloja of Legos. Bifor dey chuz am as di lyaloja of di Association of Nigerian market women and men, e don saf as tok tok lida of di maket women's association for Legos Stet. For dis kapasiti, e saf as di pesin wey tek pawa fom di forma lyaloja wey e nem na Alimotu Pelewura. Shif Mogaji kolet meni Nashional Awods for di tins wey e du fom Federal Government of Nigeria.E Kolet "Honorary Doctorate" digri fom Naijá Univasiti like Ahmadu Bello University" an University of Lagos.

How e dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shif Mogaji dai for Saturday June 15, 2013 for 96 years old an na for e own house for lkeja di capital of Lagos State. Dey later bury her for lkoyi vaults and Garden s for Lagos state.

Awards wey shi kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Orders of di Federal Republic
  • Orders of di Niger.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]