Oluremi Tinubu

From Wikipedia

Oluremi Tinubu (Dem bon ha fo September 21 1960). Shi kom from Ogun State, Nigeria. shi don bi fes ledi of Lagos State an shi bi di kurent senator wey dey represent Lagos Central Senatorial District fo National Assembly. Shi bi member of All Progressives Congress (APC) political party.

Hau shi stat laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pastor Oluremi Tinubu na di youngest of 12 pikin for di family, na fo Ogun State shi grow.

Skool-dem wey shi go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pastor Oluremi Tinubu go Lady of Apostles Sekondary Skool Ijebu-Ode where shi get West African Senior Secondary School Certificate (WASSC) fo 1979. Tinubu get e B.S. in Education from the University of Ife, an National Certificate of Education fo Botany and Zoology from Adeyemi College of Education.

Wok fo politik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pastor Tinubu bikom di fes lady of Lagos State wen her husband, Bola Tinubu, bikom govnor. As fes lady, shi stat di New Era Foundation, di fokus of di foundeshun na to bring "all round development of young ones and promote public awareness on environmental health and community service." Wen dem elekt Tinubu, dem been challenge am fo di Legislative House Election Petition Tribunal - but di result of di tribunal fo 2012 bi sey Tinubu win. Tinubu dey among over 100 senator-dem wey dem elect fo di 8th assembly fo 2015. Six of of dem na women. Aside from Tinubu, di other woman-dem na Stella Oduah, Uche Ekwunife, Fatimat Raji Rasaki, Rose Okoji Oko and Binta Garba. Fo di 2019 general election, shi win her senatorial seat again, fo di ted taim. Fo 2016, Senator Tinubu tok sey e nid beta security from di Inspector General of Police. Dis na bikos of di gbege wey shi get from ha colleague and fellow party member Dino Melaye wen dem do wan senate close-door miting. Shi dey among pipu laik Babajide Sanwo-Olu, Tony Elumelu and other Ogbonge pipu wey dem pik fo di Eko Excellence Awards fo 2019. 2020, Tinubu tok sey mek state police dey as e go hep reduce di insekurity wey dey di kontry. Fo March 2021, Senator Tinubu tok sey mek dem mek bill to chenj Nigerian Postal Service (NIPOST) to mek e dey more useful. Di Guardian organized International Women's Day Summit 2021 give Tinubu di award as woman senator wey de mek thing happen wel-wel.

Plenti-Plenti Award and honor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pastor Oluremi Tinubu win plenti award and Dem give plenti honor, di plenti-plenti award and honor wey Dem give ha na: National award of the Officer of the Order of the Niger [OON], Member, Board of Trustees of Kings’ University, Ode-Omu; Ghana Noble International Award for Leadership (2004), Gambian Diamond Award fo di ogbonge suppot to free Pipu from Poverty.

Pesona laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pastor Oluremi Tinubu na waif to former Governor and Senator of Lagos State, Bola Tinubu. Senator Oluremi Tinubu na Christian. Tinubu na ordain pastor of the Redeemed Christian Church of God. Na 2018 dem ordain am fo di Old Arena of RCCG, Lagos/Ibadan Expressway where dichurch do 66th annual convention wey title na “Dominion”. Shi still bi Grand Matron of di Committee of Wives of Lagos Sate Officials (COWLSO)