Bola Ige

From Wikipedia
Bola Ige
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejJames Ajibola Idowu Ige Chenj-am
Orijina nemJames Ajibola Idowu Ige Chenj-am
Fest nemBola Chenj-am
Wen dem bon am13 September 1930 Chenj-am
Ples wey dem bon amZaria Chenj-am
Wen e kpai23 December 2001 Chenj-am
Place of deathIbadan Chenj-am
Manner of deathhomicide Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, lawyer Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Oyo State, Minister of Justice, Minister of Power Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Ibadan, University College London Chenj-am
Party wey e dey for politisAction Group, Alliance for Democracy Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Bifor amPaul Tarfa Chenj-am
Replaced byVictor Omololu Olunloyo Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Chief James Ajibola idowu Ige (dem bon am on 13 September 1930 an e kpai 23 December 2001), dem sabi am as Bola Ige, na forma Naij lorya an politishan. E sarf as Fidiral Chief of Justice of Nigeria fom January 2000 bifor dem kil am in December 2001. E sarf as govnor of Oyo State fom 1979 rish 1983 Nigeria sekond Repoblik.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

James Ajibola Idowu Adegoke Ige wey dem bon for Esa oke, Osun State Nigeria on 13 September 1930. Im papa an mama na Yoruba pipu of Esa Oke town, for old Oyo State (wey kon bi Osun State). Ige komot for Kaduna go south to di pat of Western region wen e dey 14 years old. E go Ibadan Grammar School (1943-48), an leta go University of Ibadan. Fom dia, E go University College London, wia e finish lor digre in 1959. Dem kol am to bar insaid London's Inner Temple in 1961. Ige stat Bola Ige an co in 1961, an leta kon bi Senior Advocate of Nigeria. Dem sabi am wel wel wit Di wey e dey tok, an hau e dey tek faight for pipu rait, an di Kain wey e dey du im wok. Na Christian Ige bi. Ige sabi spik di three langwej wey dem uze sabi Naija; Hausa, Igbo an Yoruba wel wel. E rait difren buks an afta e kpai, dem rait plenti buks abaut am.

Hau e tek stat im politis wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

For fest Roplik time (1963-66) , wen e dey 31 years old, na im dem sabi pas for Afrika grup katakata wey hapun, na web Chief Obafemi Awolowo no gree with im deputy, Chief Oladoke Akintola. Na im an Olusola Olaosebikan dey put eye for Obafemi Awolowo posishon. Na Ige bi di kommisiona for Agriculture wey kon leta bi Western Region of Nigeria (1967 - 70) onda militiri govmet of General Yakubu Gowon. In 1967, im an Olusegun Obasanjo bi frend, wey bi kommanda of di Army brigade in Ibadan.

For stat of 1970's, wen fest militiri rul stat, e put plenti of im time to mek pipu no dey hate diasef wit World Council of Churches campaign.

As 1970's wan finish e join Unity Party of Nigeria (UPN). Wen General Olusegun Obasanjo wan stat Sekond Repoblik, e enta as govnor of Oyo State fom October 1979 rish October 1983. Adebisi Akande, wey kon leta bi govnor for Osun State, na im deputy for Oyo dat time. Insaid 1983 eleshon, Dr Victor Omololu Olunloyo, win am an no mek am enta for sekond time. Ige Kari am go kourt sey Di eleshon na ojoro but e lus for kourt. Olunloyo leta komot for di posishon afta three-months bikos of di coup wey General Muhammadu Buhari an Tunde Idiagbon stat.

Dem kach Ige afta di coup, bikos dem tok sey e dey uze parti moni on imsef. Dey rilis am in 1985, afta anoda coup hapun, by Ibrahim Babagida, wey kon mek am go bak dey du lor tims an to dey rait. In 1990, e du People, Politics And Politishan of Nigeria: 1940 - 1979, buk wey e don dey rait sins e dey prison. E dey insaid pipu wey stat Yoruba grup, Afenifere.

Fourth Repoblik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta web Democracy don stand wel wel for 1999, Ige trai mek e enta onda Alliance for Democracy parti as president but e no enta. President Olusegun Obasanjo selet Bola Ige as minista of Mines an Power (1999 - 2000). E no mek laight for Naija dey holways by National Electric Power Authority (NEPA).

E kon bi minista of Justice an Attorney General of di fedira repolik of Nigeria (2000 - 2001). In September 2001 Ige tok sey govmet don du plan wey go mek plenti pipu sabi lor, sey dem go re-arenj am Nd put am for website of di ministry.

Na wen Ige wan kolet niu posishon for United Nations International Law Commission dem kil am wit gun for Ibadan, wey bi Oyo State capita.

Buks wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Golden Quotes: a selection of my favourite inspirational quotations. Ibadan : Pocket Gifts ; Oxford : African Books Collective [distributor], c2000. x, 163 pp.; 19 cm. ISBN 978-129-496-5

Detainee's Diary Ibadan : NPS Educational, 1992. 262 p. ; 23 cm. ISBN 978-2556-45-9 People, Politics And Politicians of Nigeria: 1940–1979. Heinemann Educational Books. 1994. ISBN 978-129-496-5. Constitutions and the problem of Nigeria Lagos: Nigerian Institute of Advanced Legal Studies, 1995. 36 pp.; 21 cm. ISBN 978-2353.

Kaduna Boy. NPS Boy educational. 1991. ISBN 978-2556-35-1.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1.Kaye Whiteman (1 January 2002). Bola Ige - Dedicated Lawyer building bridges in Nigeria Politics. The Guardian (UK) Retrieved 02 August 2023.