Adebisi Akande

From Wikipedia
Adebisi Akande
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAdebisi Chenj-am
Wen dem bon am23 January 1939 Chenj-am
Ples wey dem bon amIla Orangun Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Osun State Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress, Alliance for Democracy Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am

Chief Abdulkareem Adebisi Bamidele Akande (dem bon am on 16 January 1939) na Naija politishan, na bifor bifor govnor for Osun State fom 1999 rish 2003, na Alliance Democracy (AD) parti memba e bi web e enta as govnor. Na im bi di fest pesin wey fes stand as Chairman for All Progressives Congress (APC).

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Chief Adebisi Akande wey dem bon insaid Ila Orangun on 16 January 1939 wey kon bi Osun Centra Senatorial district, e enta as Unity Party of Nigeria (UPN) memba. Akande na Cheif Bola Ige famili.

Govnor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akande enta as govnor of Osun State insaid 1999 Osun State eleshon, wen e komot out onda Alliance for Democracy (AD) parti. Na afta Col. Theophilus Bamigboye, wey enta onda militiri govnor for di State in August 1988, Akande enta. On 31 May 1999, Akande opun di sekond Assembly in Osun State.

In January 2000, di Osun stet sak 143 workas of di Osun State Broadcasting Cooperation, na wen govnor tok sey e wan chenj hau wokas dey wok for di stet. Akande komot stet Kansu of Oba's an Cheifs in 2001, bikos e tu big. E komot stet Kansu bikos im an di bifor bifor roya head of di Kansu no gree for diased. Di Ooni of Ife an Akande, wey im deputy govnor, Iyiola Omisore leta join d faight.

For November 2001, Akande dey fes serious wahala bikos som pipu no tu lik am, wey mek plenti katakata hapun for di stet, ezampu na wen Modakeke an Ife faight. Akande get beta plan for im pipu wey mek am dey giv free edukashon an free medisin, e stil mek pipu dey get plenti wota. Na hol dat one mek pipu lik am smol an kon mek dem no wan komot am for pawa.

On 24 December 2001, pesin wey dey sopot Akande, Bola Ige, di minista for justice, dem kil am for im haus wey dey Ibadan. Naija paper, ThisDay Newspaper tok sey as Dele Ige kpai, e fit bi bikos of di katakata wey Bisi Akande get wit im deputy govnor, Iyiola Omisore. Week wey folo di week wey Omisore kpai, Odunayo Olagbaju wey dey insaid pipu wey dey du lor for Osun Stet sef kpai, dem kil am for front of Im haus. Olagbaju na sopota for Omisore.

Akande trai to enta sekond taim for govnor, but Prince Olagunsoye Oyinlola of People's Democratic Party (PDP) win am.

Hau e kon leta wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen 2023 dey end, anoda pat for AD du difren convenshon. Di one wey dem du for Legos, na Akande dey chuz as dia chairman. In January 2006, anoda pat for di parti wey dey sopot Chief Mojisola Akinfenwa as nashonal chairman, som bad boiz atak dem for Osogbo, wey bi kapita for Osun State.

One intavew wey forma senator, Moji Akinfenwa du insaid February 2006, shi tok sey Akande no bi AD chairman an sey plenti moni wey Akande use du eleshon na im deputy, Omisore get am.

In June 2005, Akande go one Intanashonal Confrens wey dem du for Imperial College, London. In October 2005, Akande go US go tok wit AD membas wey no dey Naija.

Wen e get chans to tok abaut hau dem dey Kari pipu kip to kolet moni for Niger Delta aria, e tok sey hau di tin go stop na if dem giv hol di yong pipu beta wok to du, an mek dem tu dey wan dem wan du lor. E tok sey mek dem no use solja an fors setu di mata.

In October 2009, di Osun Stet Commisiona for Edukashon, Alhaji Jelili Adesiyan, sey as di stet no du wel for examinashon na bikos di Akande govmet no don foget skuls for di stet.

In September 2006, Akande pat for di parti an som oda partis stat di Action Congress party, wey leta chenj dia nem to Action Congress of Nigeria.

In February 2013 di parti tel pipu sey dem plan to dey wit Di Congress for Progressive change (CPC), Di All Nigeri People's Party (ANPP), an pat of All Progressives Grand Alliance (APGA) to form di All Progressive Congress (APC).

Wia dey gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Emergency Declared in Nigeria after Killing of Justice Minister. New York Times. 25 December 2001. Retrieved 23 August 2023.

2.Gbenga Olarinoye(27 October 2009) Commissioner blames poor WEAC, NECO results on Akande. Vanguard. Retrieved 02 August 2023