Asake

From Wikipedia

Ahmed Ololade (dem bon am January 13, 1995) wey pipo sabi wel wel as Asake na Naija Afrobeat singa an song raita. Asake de onda YBNL Nation an Empire Distribution rekod lebel kompini. Di nem Asake wey meni pipo tek no am bi di nem of e mama.

For February 3, 2023, Asake, Kiss Daniel, Snazzy the Optimist, an Lucid bi di nem-dem wey pipo chek dia muzik pass as singa akordin to Audiomack.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Asake rid akt for Obafemi Awolowo Yunivasiti wey de Naija. E stat to dey rilis muzik in 2008. Na di muzik "Mr Money" mek am blow wel wel. Leta, Asake kom du di remix of "Mr Money" an Zlatan an Peruzzi folo sing for di remix. For February 2022, Naija singa Olamide sahin Asake to e rekod lebel YBNL Records. For dat February, Asake rilis e fest habom Ololade an inside dat habom di muzik wey mek am popula wel wel "Omo ope de inside. Olamide join sing inside "Omo Ope". Anoda song wey de inside di habom na "Sungba". Asake du di remix of "Sungba" one month leta an e kol Burna boy to join sing inside. Asake in July 2022 sahin wit Empire rekod sey mek dem helep am dey sel e habom.

Na on September 8, 2022 Asake rilis e fest studio habom Mr Money and the Vibe, Seven month afta wey e don rilis e habom EP. Di habom get hit singu like "Terminator", "Peace be unto you" an di "Sungba" remix wit Burna boy. Meni pipo for Naija an overseas like di habom wel wel as di break meni rekod for di wold. Leta for di year, Asake stat e program to go around di wold to sing an e sel tiket three times sey e go sing for 02 Academy Brixton wey de London. For September 2022, Asake Tom sey e go sing "Mr. Money with the Vibe"' in UK.

Wen last day wey Asake wan finish e show for 02 Brixton Academy, meni pipo get injuri bikos of rush rush wey dem dey di dat day. Dis rush rush kill two pipo; 33 year old Rebecca Ikumelo an di 22 year old Sekwuriti man Gaby Hutchinson.

Asake win di Male MVP awod at di Soundcity MVP Awod wey dem du for Eko Convenshon Senta in Legos on February 2023. For April 2023, Asake tok for Good Morin Amerika show to diskuss e Muzik.

Some pipo tok sey Asake dey yuz Fuji dey sing e muzik bikos of sey e dey yuz Yoruba an some slang for e song.

Awod-dem wey e don kolet[chenj-am | chenj-am for orijin]

Asake win di "Best African Artist of the Year" for di Vodafone Ghana Music Awod .

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Studio Album

Title Album details Peak chart positions
Top 50 Nigeria Irish Album Charts UK Albums Chart United Kingdom Billboard 200 United States
Mr Money with the Vibe 1 22 66
Work of Art
  • Released: 16 June 2023
  • Label: Empire Distribution, YBNL Nation
  • Formats: Digital download, streaming
1 59 20 66


Extended plays[chenj-am | chenj-am for orijin]

Title EP details
Ololade
  • Released: 16 February 2022
  • Label: YBNL Nation, Empire
  • Format: Digital download, streaming

Singles

As lead artist[chenj-am | chenj-am for orijin]

List of singles as lead artist, with selected chart positions
Year Song Peak chart positions Ref.
2022 "Sungba Remix" featuring Burna Boy No. 7 US Afrobeats Songs
2022 "Peace Be Unto You" No. 1 Nigeria (TurnTable)
No. 7 US Afrobeats Songs
2022 "Terminator" No. 82 UK Charts,
2022 "Trabaye" featuring Olamide
2023 "Yoga"
2023 "2:30"
2023 "Amapiano" featuring Olamide

As featured artist[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Song Peak chart position Ref.
2022 "Pallazo" by DJ Spinall No. 6 US Afrobeats Songs
2022 "Bandana" by Fireboy DML No. 8 US Afrobeats Songs
2022 "Loaded" by Tiwa Savage
2023 "No Competition" by Davido
2023 "New Religion" by Olamide date=June 2023


Music videos[chenj-am | chenj-am for orijin]

List of music videos as lead and featured artist, showing year released and directors
Title Year Director(s)
(Asake featuring Olamide 2022 TG Omori
"Sungba" (Asake) TG Omori
"Sungba Remix" (Asake featuring Burna Boy) TG Omori
(DJ Spinall featuring Asake) TG Omor
(Asake) TG Omori
(Asake) TG Omori
(Asake) TG Omori
(Tiwa Savage featuring Asake) TG Omori
(Asake) TG Omori
"Yoga" 2023 TG Omori
"2:30" Joshua Valle & Edgar Esteves
(Asake featuring Olamide) Jyde Ajala
"Basquiat" Joshua Valle & Edgar Esteves
“Remember”

Wia di gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]