Fireboy DML
Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Adedamola Adefolahan |
Orijina nem | Adedamola Adefolahan |
Fest nem | Adedamola |
Famili nem | Adefolahan |
Alias | Fireboy DML |
Wen dem bon am | 5 February 1995, 5 February 1996 |
Ples wey dem bon am | Ogun State |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej |
Wok wey e dey du | singer-songwriter |
Pat of wok wey e put mind | art |
Wie e go skul | Obafemi Awolowo University |
Wie e dey liv | Lagos |
Wen e stat wok | 2012, 2012 |
E pipul | Yoruba pipul |
Rilijon | Christianity |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Instrument | music |
Discography | Afro |
Notable work | Laughter, Tears and Goosebumps |
Memba of | YBNL |
Stai of song abi fim | contemporary R&B, Afrobeat |
Record label | YBNL Nation, Empire Distribution |
Awod wey e kolet | City People Entertainment Awards, Soundcity MVP Awards Festival, The Headies, All Africa Music Awards |
Nominated for | The Headies, Soundcity MVP Awards Festival, African Entertainment Awards USA, NAACP Image Awards |
Official website | https://fireboydml.com/ |
Personal pronoun | L485 |
Adedamola Oyinlola Adefolahan (dey bon 5 February 1996) wey pipo no wel wel as Fireboy DML na Naija singa. Na Olamide YBNL Nation rekod level sahin am. Fireboy rilis e studio habom Laughter, Tears and Goosebumps in 2019. E win listina choice awod an e nem de di 2020 Song of di year katigori for Soundcity MVP Awod Festival.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Song wey mek pipo no Fireboy DML wel wel Jealous fest de YBNL Neshon kolaborashon habom "YBNL Mafia Family"(2018). Di song leta kom out again on 25 March 2019. Na Cracker Mallo produs am an dis song tok about luv. Na Director K daret di vidio of di song.
Fireboy DML rilis one luv song kol "What if I say" on 14 June 2019. Na Pheelz produs di song an T.G Omori produs di vidio. On 1 August 2019, Fireboy DML rilis anoda song kol King. Di song tok about pesin wey e luv. Na T.G Omori produs di vidio for King.
- Laughter, Tears and Goosebumps
Fireboy DML rilis e fest studio habom Laughter, Tears and Goosebumps on 29 November 2019. Na for 25 November 2019 dey fest wan rilis am bifor dey kari am go November 29. Di habom get 13 muzik inside an na onli Fireboy DML sing all of dem . Na 6 million times dey lisin to am on Spotify for di fest 3 days afta di habom kom out. Meni pipo wey like muzik tok good tins about di habom, but some tok sey na "Afro-Life" e sing inside no bi R&B. "LTG" kontan Jealous, What if I say, an King. Pipo too like Vibration, one of di song inside LGT habom.
- Apollo and Frozen
For 17 August 2020, Fireboy DML rilis e sekod habom Apollo. Wen Pickfork wan give di habom rate di habom, dey give am 8.3 out of 10. NotJustOk tok sey Fireboy DML tok about e sef for di Apollo habom. For 2021, Fireboy DML rilis di singu Peru an "Muzik in Afrika" rait sey e rili sabi Afrobeats wel wel. Fireboy DML also sing inside Ladipoe song "Running" an WSTRN song "Be My Guest". E stil sing for Cheque song "History". Fireboy DML sing for di TV show The Tonight Show Starting Jimmy Fallon. Di song wey e sing for di show na "Vibration" from e habom Laughter Tears and Goosebumps an "Champion" from Apollo. Fireboy DML an Ed Sheeran rilis one vashon of Peru on 24 December 2021. Di song rush nomba 2 for on United Kingdom Official Single Chart in 2022.
Discography
[chenj-am | chenj-am for orijin]Studio albums
[chenj-am | chenj-am for orijin]Title | Album details | Peak chart positions | |
---|---|---|---|
US | |||
Laughter, Tears and Goosebumps |
|
— | |
Apollo |
|
— | |
Playboy |
|
123 |