Kiss Daniel

From Wikipedia

Oluwatobiloba Daniel Anidugbe (dem bon am for May 1, 1994) wey pipu no as kizz Daniel, na Naijá singa an pesin wey dey rit song. Pipul sabi am wel wel for di song Woju an Yeba wey im sing. pipul sabi am as kiss Daniel bifor em kon chuz anoda nem wey bi Kizz Daniel for May 2018. Daniel put hand for kontrat wit G-Worldwide Entertainment for 2013, im komot for dia wen dem no gree for demsef ova kontrat mata. Na so im go stat e own Fly Boy Inc record label for November 2017.

Tori abaut e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oluwatobiloba Daniel Anidugbe bi di nem wey Kiss Daniel papa nem am fom smol.Na Abeokuta for Ogun Stet in Naijá na im e kom fom.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kiss Daniel go Abeokuta Grammar School, afta dat one e kom go Federal University of Agriculture, Abeokutafor 2013.E go rid Water Resources Management an Agrometeorology(Water Engineering). Na wen e stil dey skul na e don stat to sing.

Im pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

By May 1 2021, Kiss Daniel don bon three pikin. Di nem of e Pikin bi Jalil, Jamal, an Jelani.Na leta em kom tok sey one of di pikin don dai.Daniel buy hauz for di two pikin wey bi Jalil an jelani.

Im karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

For May 2015, Kizz Daniel drop e song Laye, na di day wey dem bon am im drop di song.Aje Films wey bi ogbonge pesin wey dey du vidio for music do di music vidio. Na difren plaz for Naijá dey tek du di vidio.