Jump to content

Annie Macaulay–Idibia

From Wikipedia
Annie Macaulay–Idibia
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAnnie Macaulay–Idibia Chenj-am
Orijina nemAnnie Macaulay–Idibia Chenj-am
Fest nemAnnie Chenj-am
Famili nemMacaulay-Idibia Chenj-am
Wen dem bon am13 November 1984 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Pesin wey e mari2baba Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumodel, actor, presenter, beauty pageant contestant Chenj-am
Wie e go skulLagos State University, University of Lagos Chenj-am
Wie e dey livLagos Chenj-am
Wen e stat wok2009 Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
FilmographyYoung, Famous & African Chenj-am
Personal pronounL484 Chenj-am

Annie Macaulay–Idibia (dem bon am on 13 November 1984) na Naija model, presenta an aktres. Im nem dey insaid pesin wey dem kol wey fit win "Best Supporting Actress" katigori insaid 2009 Best Nollywood Awod.

Hau shi tek stat life an edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Annie for Ibadan but na fom Eket wey dey Akwa Ibom Stet, shi kom fom. Shi kom Legos afta im mama an papa no dey togeda. Shi get digre in Computer Science an Theatre Arts afta shi finish ondagraduate korse for Legos Stet Universiti an Universiti of Lagos.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor shi stat to dey akt shi don go for Queen of All Nations pageant, kompetishon wey shi kari sekond. Shi dey insaid 2 face "Afrika Queen" Video.

Im Nollywood wok wey mek plenti pipu sabi am na Pleasure an Crime an Blackberry Babes. Shi tok sey belle swit am wel wel as Shi dey for front pej of di Glamour South Afrika Niuspepa.

Netflix Afrika sho wey dem kol Young, Famous & African, wey dem stat on 18 March 2022, Annie Idibia an im hosband "2Baba" Indibia dey dia an som oda Afrika wey pipu sabi wel wel lik; Diamond Platnumz, Naked DJ, Nadia Nakai, Swanky Jerry, Andile Ncube, and Kayleigh Schwark.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • First Family
  • Pleasure and Crime (2010) as Steph
  • White Chapel (2011) as Vivian
  • Eight (2015)
  • The Wanted Girl (2014) as Eva
  • Blackberry Babes (2011) as Kimberly
  • Return of Blackberry Babes
  • Estate Runs
  • Young, Famous & African
  • Unconditional[1]
  • Obiageli The Sex Machine
  • Morning After Dark (2014) as Servant
  • Beautiful Monster (2014) as Servant
  • Open Scar
  • Secret Lovers
  • Desires of Married Women
  • Love Across (2021) as Dichie
  • Almajiri (2022) as Hench Woman
  • Married But Feminist (2023) as Caro

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Macaulay - Idibia Mari 2face an dem bon two pikin. Shi bon im fest pikin, wey bi girl Isabel Idibia, an dia sekond pikin, Olivia Idibia.

Awod an norminee[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Award ceremony Prize Result
2009 2009 Best of Nollywood Awards Best Supporting Actress Nominated
2016 African Entertainment Legend Awards Fast Rising Actress Won[2]

Pruf for di tori dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "Uche Jombo Produces New Movie 'Unconditional' Starring Dakore Akande & Annie Macaulay Idibia [WATCH THE TRAILER]". 21 September 2013. Archived from the original on 17 October 2015. Retrieved 9 September 2015.
  2. "Annie Idibia wins African Entertainment Legend Award". Nigeria Entertainment Today. 2 February 2016. Archived from the original on 2 February 2016. Retrieved 2 February 2016.