Alex Otti

From Wikipedia
Alex Otti
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAlex Chenj-am
Wen dem bon am18 February 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbia State Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Igbo langwej Chenj-am
Wok wey e dey dueconomist, banker, politician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Abia State Chenj-am
Wie e go skulHarvard Business School, University of Lagos, University of Port Harcourt Chenj-am
Wie e dey livLagos Chenj-am
Wen e stat wok1989 Chenj-am
Party wey e dey for politisLabour Party Chenj-am

Alex Otti (dem bon am February 18, 1965) na Naija business man, banka, investor, politishan an e like to dash pipo tins. Na Otti Abia pipo chuz to bi dia govnor in di March 18, 2023 govnor eleshon wey hapun for Abia Stet. E bi di forma Manejin Daretor (M.D) of Diamond Bank Plc wey de Naija. Otti yuz di parti All Progressives Grand Alliance (APGA) tek kampain to bi di govnor of Abia Stet. Otti de among di pipo wey dem kontro Thisday niuz-pepa an e dey rait one hatikul evri two monday of di week. Di tahitu of Otti hatikul bi: "Outside The Box".

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na February 18, 1965 dem bon Alex Otti in Umuru, Umuehim vilej in Ehi Na Uguru Kindom, Isiala Ngwa South LGA of Abia Stet. Otti papa na pasto an e nem na Lazarus Weze Otti. Otti du e sekondri edukeshon for Ngwa Hi Skul, Aba an e finish for Sekondri Teknika Skul, Okpuala Ngwa in Abia Stet. Wen di risot of WAEC wan komot out, na Otti bi di best studet dorin e set. Otti kom enta Yunivasiti of Port Harcourt to go rid ekonomik. E finish wit Fest klass in ekonomik in 1988 from di yunivasiti.

In 1994, Otti kolet e MBA digree satifiket from di Yunivasiti of Legos. Otti don go meni intanashonal korse wey inklud: "Executive Development Programmes of the Columbia Business", Stanford Business School", an Wharton Business School ([[University of Pennsylvania|Yunivasiti of Pennsylvania). E stil du one ezekutiv program at INSEAD, Fontainebleau, France.

In 2009, Babcook Yunivasiti, give Otti "honorary doctorate degree" an in 2012, Yunivasiti of Port Arcourt give am "honorary Doctor of Science" (D.Sc) digri. Otti stil kolet anoda "honorary doctorate degree" from Yunivasiti of Nigeria, Nsukka.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Otti stat to dey wok for bank in 1989 an na Nigerian International Bank e fest stat. Nigerian International Bank de onda Citibank New York. Na for di hopireshon dipatmet Otti dey wen e de di bank. Leta, Otti stat to dey wok for Nigerian Intercontinental Merchant Bank Ltd. Wen e dey Intercontinental Bank, Otti wok for dia financial savis dipatmet as also for dia kopuret bankin divishon. In 1992, e join "Societe Bancaire Nigeria Limited" (Merchant Bank), di bank de onda "Banque SBA Paris". In Merchant Bank, e rish di posishon of sinior manija. Ottis kom enta "United Bank for Africa" (UBA) as dia prinsipa manija an na e bi monitor dia banki kopuret secto for di entaya South Divishon. E mejo wok na to mek suo sey di orye an gas biziness gro wel wel. Wen May 2001 rish, Ottis stat to dey wok for "First Bank of Nigeria PLC" as dia hasista jenera manija an e wok na to gro di enaji secto of di bank. By April 2004, Otti don bikom di depoti jenera manija, an one year leta, e vikom ezekutiv dareto, komashiha bankin. Leta, Otttis bikom di ezekutiv dareto south directorate. As ezekutiv dareto south directorate, e dey kontro ova 140 brashis of bank wey de South-South an South Easta pat of Naija. In March 2011, e kom from "First Bank" enta "Diamond Bank" as dia CEO. Ottis rili helep mek Diamond Bank bi beta bank. Wen di date wey Diamond Bank sahin wit Otti finish, di bank sahin 3 year wit am again in March 2014.

Ottis ritaya by imsef on October 24, 2014 an Uzoma Dozie tek ova as di niu GMD of Bank CEO.

How e tek wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ottis komot as pesin wey go like di govno for Abia Stet onda di politika parti APGA. For December 31, 2015, Di "Court of Appeal" komot govno Okezie Ikpeazu wey enta onda PDP parti an tok sey na Ottis win di govno eleshon wey dem du for April 11 an April 25 wey hapun for Abia Stet. For February 3, 2016, di kot wey hi pas for Naija, "Supreme Court" no gree as tok sey na Okezie Ikpeazu stil bi di govno of di stet.