Akpororo

From Wikipedia
Akpororo
pesin
Industryfilm industry, entertainment industry, cinema of Nigeria Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am3 October 1989 Chenj-am
Ples wey dem bon amWarri Chenj-am
Pesin wey e mariunknown value Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulLagos State University Chenj-am
Academic degreeBachelor of Arts Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Notable workThe Antique Chenj-am
Awod wey e kolet2015 Golden Icons Academy Movie Awards Chenj-am
Nominated for2015 Golden Icons Academy Movie Awards, 2014 Nigeria Entertainment Awards, 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards, 2016 Nigeria Entertainment Awards Chenj-am
Endorsed byAirtel Africa Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Bowoto Jephthah Oluwatiseyifunmi Tanimola wey pipo no wel wel as Akpororo na Naija komendian, singa an aktor

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akpororo na "Ilaje" pesin wey kom from Ondo Stet. Na for Warri wey de Delta Stet Akpororo tek gro up an na Delta e tek go skul. Akpororo dey rid Soshiorloji. Akpororo na 5ft, 7 inches

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2008

Akpororo fest dey sing Kristen song for lokal aria onti 2008 wen e tek pat in Nashonal Komedi Shalenj. Na Opa Willias get di sho. Akpororo kari fest for di pat wey dem do for Kalabar.

  • 2009

Akpororo kom to Legos in 2009 an e join for AY Opun Mic Shalenj. Di two time wey Akpororo pafom for di sho, e kari sekod an di next one wey folo, e kari fest.

  • 2013

Akpororo pafom for "Basketmouth Laff an Jam" sho.

Na dis sho mek pipo sabi Akpororo wel wel. Akpororo kom start to dey pafom inside meni Komedi sho like AY Live

  • 2014

For 12 August 2014, Akpororo do e fest Komedi sho wey e kol "Akpororo vs Akpororo" inside Muson Sentral. In di sem 2014, Akpororo start to dey Akt fim an e Akt inside "Headgone", an anoda fim The Antique. Di way Akpororo tek Akt inside "Headgone mek dem nominee am three time at di 2015 Goldin Icons Akademi Awod.

How e dey tok e jokes[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akpororo like to dey tok funny tins wey dey happun for chorch. E tok sey na bikos e don bifor bi pesin wey dey kontro menta pipo group wey kom chorch.

Kompini wey e don helep sell dia prodot[chenj-am | chenj-am for orijin]

For June 2015, Akpororo sahin 2 year pepa with fone line kompini Airtel Naija.

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Awod serimoni Prize Resolt Ref
2016 2016 Nigeria Entertainment Awards Best Comedy Act Nominated
2016 Africa Magic Viewers Choice Awards Best Actor in a Komendi Nominated
2015 2015 Nigeria Entertainment Awards Komedi Act of the Year Nominated
2015 Golden Icons Academy Movie Awards Best Komendi Act Won
Best New Aktor Nominated
Best Komendi Akt (View's Choice) Nominated
2014 2014 Nigeria Entertainment Awards Komendi Akt of the Year Nominated
2014 BEN Television Awards Comedian of the Year Nominated
2014 Naija FM Comedy Awards Best Comedian of the Year Won

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akpororo Mari Josephine Ijeoma Abraham on 14 November 2015. Di marej happun in Surulere, Legos Stet