Yusuf Datti Baba-Ahmed

From Wikipedia
Yusuf Datti Baba-Ahmed
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemYusuf Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria Chenj-am
Party wey e dey for politisCongress for Progressive Change Chenj-am

Yusuf Datti Baba-Ahmed ( dey bon am 7 July 1969) na Naija ekonomis an politishan. Baba-Ahmed na bifor bifor Sinetor for Kaduna North in 2011. From 2003 go rish 2007, e na memba of House of Repisentetiv, Na Baba-Ahmed Lebor Parti (LP) pik to bi di vais presidet for di 2023 presidenshial eleshon with Peter Obi as dia presidenshial kandidet.

Baba-Ahmed kom from Zaria an e go Yunivasiti of Maiduguri. Wen e finish skul, Baba-Ahmed enta bizness an bankin wok bifor leta join politis. Wen Baba-Ahmed stil de House of Reprisentetiv, pipo no am as pesin wey no dey sopot korupshon an pesin wey fight against di Third term Agenda wey forma presidor Olusegun Obasanjo wan do. Wen e finish as memba of House, Baba-Ahmed kontiniu to dey tok an sopot gud govamet as e dey faze e bizness. Na Baba-Ahmed get Baze Yunivasiti.

Baba-Ahmed kom bak to politis in 2010 an e win di eleshon wey e enta to bi di Sinetor of Kaduna North. Na onli one year e yuz as di tribunal tok sey mago mago dey di eleshon as e komot in 2011. Wen Baba-Ahmed to win di 2018 pamari eleshon wey PDP do to bi presidental kandidet, e join Lebor Parti to bi di vais-presidet for Peter Obi in 2022. Wen di risot of di eleshon kom out, Na Bola Tinubu win as presidet of Naija an Kashim Shettima win as e vais-presidet.

How e tek start life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yusuf Datt Baba-Ahmed dey among di 33 pikin-dem wey e papa Baba-Ahmed bon. Baba-Ahmed papa na Arab pesin wey dey do sell goat, sheep an cow bizness. Baba-Ahmed papa leta bikom a skolar an pesin wey no Islamic law wel wel. Baba-Ahmed get B.Sc an M.Sc in Ekonomik from di yunivasiti of Maiduguri wey de Borno Stet. E don bifor wok for The Nigerian Security Printing and Minting PLC Legos. Na afta dis wok e do last bifor e fest enta politis.

For 2016, wen e stil bi Fediral repisentativ, Baba-Ahmed get e Ph.D satifiket wen from Yunivasiti of Westminster.

How e tek wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for April 2003 Baba-Ahmed win di eleshon to di Fediral House of Repisentativ for di Zaria Fediral Konstituensi, Kaduna Stet. E yuz ANPP ( All Nigeria Pipo Parti tek kampain an win di eleshon. Pipo like Baba-Ahmed bikos e no dey tek nosens wen e dey politis. E dey among di pipo wey no sopot forma presidor Olusegun Obasanjo for go for di third time as presidor. Baba-Ahmed tok sey e no go kari post for di sekod term bikos som of dem don kolet moni for bak to sopot wetin Obasanjo wan do. For 2007, e kari INEC (Indipedet Nashonal Electoral Kommishon go jog bikos of wetin dey do for eleshon pirod. Baba-Ahmed yuz CPC (Kongress for Progresiv Parti win di Kaduna North Sinetorial eleshon in 2011. CPC na Muhammadu Buhari politika parti.

How e tek sopot edukeshon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Baba-Ahmed bi di fonda an Pro-Shasellor of Baze Yunivasiti. Di yunivasiti dey Abuja for Naija. Na for April 2011 dey opun di yunivasiti.