Yinka Ayefele

From Wikipedia
Yinka Ayefele
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1 February 1968 Chenj-am
Ples wey dem bon amEkiti State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Official websitehttps://yinkaayefelemusic.com/ Chenj-am

Yinka Ayefele MON na Naija music producer, gospel singer, CDS, VCDS, radio presenter and oga kpatakpata of Fresh FM Radio Station, Ibadan.

Wia dem born am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Ayefele for Ipoti-Ekiti wey be one small town inside Ekiti State of Nigeria.

How im take go school[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayefele bin attend Our Saviours Anglican Primary School inside Ipoti-Ekiti for im primary and secondary education before e lata waka go Ondo State College of Arts and Science for Ikare Akoko, Ondo State, Nigeria.

How e take start[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayefele work small as journalist and broadcaster for Federal Radio Corporation of Nigeria, Ibadan, wia im dey produce jingles and musical works for radio.

Ayefele start im music career for 1997 after he im bin get motor accident wey damage im back bone wey come make am to dey use wheelchair as e no fit waka again. Na after about 9 months wey im don dey inside hospital na im Kola Olootu wey be im friend visit am come advise make im  try arrange some songs put together. Na this advice  make Ayefele come release im first album wey be, Bitter Experience for 1998 wey come catapult am enter limelight. Im come release another album follow  Bitter experience wey im call Sweet Experience. Other albums wey im release be Something Else, Divine Intervention and Life after death, wey im take honor Gbenga Adeboye, a Naija radio presenter, musician and comedian. The title Bitter Experience na im torchlight his experience wen im get accident wey  Sweet Experience come be the sweetness wey follow the "Bitter Experience".

Yinka Ayefele music house ado ekiti

Award wey im collect[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ayefele don collect over 200 awards. Some of the awards wey im don collect be:

  • Ekiti cultural ambassador award

Im radio station[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yinka Ayefele be the owner of Fresh FM 105.9 FM radio station wey dey Ibadan for inside Oyo state. The radio station bin start operations in 2015 after NBC give dem licence on the 30th April, 2015.

Ayefele's Music House, Challenge Ibadan

Ayefele's Music House,wia im dey operate im radio station Fresh FM plus including studio, na im Oyo State Government demolish on August 19, 2018 on top say wia the building dey no follow the laws of the town planning authority.

Albums wey im don release[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Bitter Experience (1998)
  • Sweet Experience (1999)
  • Something Else (2000)
  • Divine Intervention (2001)
  • Fun Fair (2002)
  • Life after Death (2003)
  • Aspiration (2003)
  • Fulfilment (2004)
  • New Dawn (2005)
  • Next Level (2006)
  • Gratitude (2007)
  • Absolute Praise (2008)
  • Transformation (2009)
  • Everlasting Grace (2010)
  • Prayer Point (2011)
  • Goodness Of God (2012)
  • Comforter (2013)
  • Overcomer (2014)
  • Upliftment (2015)
  • Fresh Glory (2016)
  • Living Testimony (2017)
  • Favour (2018)
  • Beyond The Limits (2019)        
  • Ekundayo (Exhilaration) (2020)