Gbenga Adeboye

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Gbenga Adeboye(dem bon am for September 30, 1959 an e dai for April 30, 2003) na Naijá pesin wey du komedi, dey sing, dey du MC an dey tok for redio.

How Im Life tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Elijah Oluwagbemiga Adeboye on September 30, 1959 for one ples for Odeomu inside Osun stet for Naijá in West Afrika.

How Im Tek Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeboye bin dey host one program for redio wey dem dey sho for Legos Stet Brokastin koporeshion for 1980. Na dat program mek pipul stat to dey kol am Funwontan Oduology.Idowu Philips wey bi one Naijá wuman wey don dey du fim tey tey tok gud tin abaut am sey e no dey tight-han, di fest moto wey shi get na Gbenga giv am as gift. Bifor kidney problem kil am for April 30, 2003 pipul wey dey sopot am stil tok sey Gbenga na koret pesin wey sabi du lokal Oduology.

Stil chek dis one[chenj-am | chenj-am for orijin]