Yahaya Bello

From Wikipedia
Yahaya Bello
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejYahaya Adoza Bello Chenj-am
Orijina nemYahaya Adoza Bello Chenj-am
Famili nemBello Chenj-am
Wen dem bon am18 June 1975 Chenj-am
Ples wey dem bon amOkene Chenj-am
Pesin wey e mariAmina Oyiza Bello Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, businessperson Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Kogi State Chenj-am
Wie e go skulAhmadu Bello University Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Yahaya Adoza Bello(dem bon am on 18 June 1975) na Naija politishian wey dey sarf as govnor of Kogi Stet sins 2016.[1] Na mamba of All Progressive Congress, na Bello bi di govnor wey smol pas for age insaid govnor wey dey Naija.

Dem bon am for Okene, Bello go len accounting an biznes administration for Ahmadu Bello Universiti. Di fest taim wey e wan enta posishon of govnor e los di primari eleshon to Abubakar Audu insiad 2015. Audu win di primari an leta kpai on eleshon day an na Bello parti chuz to reples am. Four years afta e don bi di givnor wey replas pesin, e trai enta as govnor an e enta for sekond taim.

Hau e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Bello on 18 June 1975 for Okene, Kogi Stet. Na im bi di las bon for di famili of six. E go Lokal Govment Edukashon Authority (LGEA) primari skul, wey dey Okenne Kogi stet. Na im bi klas 2 head prefect an wen e dey klas four six na im bi di head boy. E go Agassa Komunniti sekondri skul, Anyava, Agassa Okene an e kon get im Junior Sekondri Certifikate Examinashon (JSSCE) an Sinior Sekondri Certifikate Examinashon (SSCE) certifikate fom Govment Sekondri Skul, Suleja,Niger Stet, insaid 1994. Bello go Kaduna Stet Polytechnic, Zaria in 1995 to stodi accountin digre fom Ahmadu Bello Universiti in 1999. Yahaya Bello stil go du Master's program for Ahmadu Bello Universiti Zaria wia dem tek giv am Masta of Biznes Administration (MBA) in 2002. Bello bi chatered memba of di Associashon of Nashonal Accountant of Nigeria in 2004.

Bello lik to sport an mek e dey wel, e lik boxin sef.

Hau e tek wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Bello win di 2015 Kogi gubernatorial elshon afta im parti, All progressive Congress chuz am to reples Abubakar Audu wey kpai, na Audu bi di pesin wey win eleshon but e leta kpai bifor dem anous resort. On 16 November 2019, Bello win for sekond term wit ova 200,00 vote gap wey e tek win PDP pesin wey bi Wada. Na Bello bi di govnor wey smol pas for age wey dem bon afta Civil War. For Abuja, on April 2 2022, Bello anous sey e wan kari eleshon to bi Naija president for 2023.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

Torch bearer of security

Sun Governor of the year (Daily Sun)

Gender Equality Award (National council of women Societies)

NUJ role model award (Nigerian Union of journalists)

Icon of security award (Association of people in Diaspora)

Security personality of the year (The institute of Security and Strategic studies)

Distinguished Hero of Women Inclusion Award (National Association of Women Entrepreneurs)

ICAN's Novel Accountability Index Award (The Institute of Chartered Accountants of Nigeria)

Presidential Award for security Management.

World Bank Fiscal Transparency, Revenue Mobilisation Awards

GRAND SERVICE STAR OF RIVERS STATE.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

2. APC Yahaya Bello re-elected Kogi govnor for Second term. 18 November 2019, The Guardian Newspaper. Retrieved October 10 2023.

3. Breaking News: Yahaya Bello wins Kogi election. December 15 2015, The Sun Newspaper. Retrieved October 10 2023.

  1. Breaking Yahaya Bello sworn in as Kogi govnor. Daily Post Nigeria 27 January 2016.