Wole Olanipekun

From Wikipedia
Wole Olanipekun
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am18 November 1951 Chenj-am
Ples wey dem bon amOsun State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dulawyer Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
Memba ofNigerian Bar Association, National Judicial Council Chenj-am

Chief Wole Olanipekun, SAN, OFR (18 November 1951) na loya for inside Naija and presido of di Naija Ba Asosieson and na Sinio Jug for Naija.

Hau im tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

I kom from Ikere-Ekiti, i go Amoye Grama Sku for Ikere-Ekiti, Ekiti Stet for saot-west Naija bot i get im West Afrika Skul satifiket for Ilesa Grama bifo i kontiniw go Univasiti of Legos, wie i get baselo digri inside lo.

Wok wey i len[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem kol am to di ba for July 1976 afta i graduet from di Naija Lo Sku and afta dat i get di rank of Sinio Jug for Naija in July 1991, di sem yia dem shus am as Atoni Genera and Komisona for Jostis of Ondo Stet and i sav for dat post for two(2) yia. For 2002, dem shus am as presido of di Naija Ba Asosieson. For 2003 dem shus am as di vais President of di Pan Afrikan Loyas Union. For January 2007, di Naija Bodi of Benchers shus am as their oga. Na im bi di Pro-Kanselo and Shiaman of Govni Kaunsu of di Univasiti of Ibadan bitwin 2004 and 2006. For 2003, dem shus am as di Vais President of di Pan Afrikan Loyas Union (PALU). Shif Oluwole Olaonipekun, SAN, OFR na di patna wey dey impotant pas of Wole Olanipekun and Co, a lidin lo fem in Naija wit di hedkotas for Legos Stet, for Naija, bransh for Abuja and dey for all di stet wey dey Naija.

Pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shif Wole Olanipekun mari Erelu Omolara Olanipekun wey bi fain wuman and dem bon 4 pikin, dem bi (Oladapo Olanipekun, SAN, Barr.Bukola Olanipekun, Olabode Olanipekun, SAN and Barr.Temitope Olanipekun) - and i bi grandfada.

Membaship[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Naija Ba Asosieson
  • Intanasona Ba Asosieson
  • Naija Bodi of Benchers

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]