Urhobo pipul

From Wikipedia
(E kom from Urhobo people)

Di Urhobo pipul na one etnik grup for Saut area of Naija for Delta Stet. Dem bi one of di etnik grup wey plenti pas for Delta Stet. Dem dey spik di Urhobo langwej.

Ogbonge pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lokeshon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Profesor Peter Palmer Ekeh, Fanda of Urhobo Historiko Sosaiti, leta rait for im buk: Studis for Urhobo Kolsho, say "Urhobo fisikali tanda for di Atlantik forest belt wey stretch fom Senegal for West Afrika rish Angola for sentra Afrika. Historikali, dis rijon na di most orijina for all of Afrika. Until di Portuguese waka enta im teritris for di late fiftinth senturi, im forest pipos bin grow dia own foms of civilizeshon, outside influences nor touch am. Dis forest belt of western Afrika, old Christian influences wey spread for North Afrika nor touch am, not even Islamic forces wey kom as far saut as Hausaland for di eleventh senturi. Doh Asian and Arab influences wey kom fom akros di Indian Ocean bin touch East Afrika and even Sentra Afrika, as di mixture of Swahili langwej prove, yet no simila trans-Atlantik influences rish di forest belt until di Portuguese waka kom for di late fiftinth senturi".

[1][2]

Marenj[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor pipo tok say dem do marenj propali for Urhobo kolsho, dem must don pray to di ancestors (Erivwin) and God (Oghene).[2] Di bride papa go say a praya and blesin wit di netif langwej for di kopo.[3][4]

At dis point, di bride go sidon for di husband lap.[3][4] Dem go give di blessed drink to di husband who go drink fest; den he go give am to im wife to drink.[3][4] Di wife go drink and pass am back to ha husband to finish, as a sign of respect.[3][4] Na dat taim pipo fit kol dem husband and wife.[3][4]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Ekeh, Peter Palmer (2005). Studies in Urhobo Culture. Buffalo: Urhobo Historical Society. p. 2. ISBN 978-978-067-769-5.
  2. 2.0 2.1 "Urhobo". Hometown.ng. Archived from the original on 2021-06-17. Retrieved 2023-03-23.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. 3.0 3.1 3.2 3.3 3.4 Sorokwu, Victor (2 September 2017). "How traditional marriage is contracted in Urhobo". Daily Trust. Archived from the original on 9 August 2020. Retrieved 1 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. 4.0 4.1 4.2 4.3 4.4 "Pastor Isaiah Ogedegbe's traditional marriage". YouTube.