Daniel Dikeji Miyerijesu

From Wikipedia
Daniel Dikeji Miyerijesu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am1948 Chenj-am

Daniel Dikeji Miyerijesu (dem bon am for January 21, 1948),[1] wey dem also sabi as Saint Daniel Dikeji Miyerijesu,[2] na di Naija bishop, lida an fonda of God's Grace Ministri. Isaiah Ogedegbe don kol am "a living saint".[3] E bin stat G.G.M for 5 November 1993.[2] Dem sabi am all ova di world "for im konsistent pashon for prishing an promoting di gud karata of holines tru di koret word of God, winning souls for Christ an bringing salveshon to di world".[1]

Akording to Sahara Ripotas, Miyerijesu "bin waka go som Urhobo vilej an e bring to di ground dia netiv shrines an meni orda places wie dem dey serve juju.[4] Dem don kritisize am for "burning lokal tradishonal shrines an destroying not onli di simbols of tradishonal spiritualiti but di art works wey dey in di forms of figors an skoptures".[5] Dem don also kritisize am for koling imsef "Di Bishop of di Whole World".[3][4]

Ministri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Miyerijesu, wey dem sabi bifor bifor as Mimeyeraye, na one of di relijos figors for di Warri Anglikan diocese,[4] wey bin stat di Anglikan Mimeyeraye Praying an Fasting Sosaiti wen e dey dia.[6]


Afta e komot from di St. James Anglikan Chorch for Ojabugbe Strit for Warri, Miyerijesu by divine leading bin stat di God's Grace Ministri wey di headkwotas na 58 Arubayi Strit, Okumagba Layout wey also dey for Warri.[2] As pesin wey dey prepare pipul for heaven, Miyerijesu dey run di evajelistik Kristen ministri wit programs for di televishon an redio wey dem dey kol: "Moment of Decishon", wey dey show for di kebol network steshons an lokal steshons.[2]

E usualli dey show face in a wine-coloured bishop's robe an a skull kap, an e mainli dey prish sey mek pipul ripent an troway dia juju.[4] Folowing in di footsteps of Cornelius Adam Igbudu,[7] e don dey also heal di sik an raise di dead.[8]

For Januari 2018, dem bin selibrate di 70th birthday of Miyerijesu in ogbonge way, an im chorch membas bin dash am a 2018 Lexus Sport Utiliti Vehiko (SUV) as a gift.[9][10]

Som years ago, Isaiah Ogedegbe bin rait one puwem abaut Miyerijesu and e bin kol di puwem: "Thank You Jesus", to thank God for im ogbonge laif.[11]

Buk[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • The Epistle of Saint Dikeji Daniel Miyerijesu to the Uromis (2017)[12]

Pej wey konsan dis one[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.0 1.1 "Oromoni felicitates with Bishop Dikeji at 74". Truth Reporters. 21 January 2022. Archived from the original on 10 June 2023. Retrieved 24 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 2.2 2.3 "ABOUT G.G.M". G.G.M Official Website.
  3. 3.0 3.1 "Open Letter To Daniel Dikeji Miyerijesu -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. 5 November 2018. Archived from the original on 2 June 2023. Retrieved 24 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. 4.0 4.1 4.2 4.3 Egbejumi-David, Michael (10 January 2011). "Jesus Holiness". Sahara Reporters. Archived from the original on 21 October 2021. Retrieved 24 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  5. Ojaide, Tanure (2017). Literature and Culture in Global Africa. Taylor & Francis. p. 47. ISBN 978-135-171-119-7.
  6. Smit, Johannes; Kumar, Pratap (2018). Study of Religion in Southern Africa: Essays in Honour of G.C. Oosthuizen. BRILL. p. 108. ISBN 978-904-740-749-2.
  7. "Daniel Dikeji Miyerijesu". NigerianWiki.com. Archived from the original on 2023-11-23. Retrieved 2023-11-24.
  8. Adeyemi, Ibrahim (12 February 2022). "INVESTIGATION: Inside details of how Dowen College pupil, Sylvester Oromoni, died". Premium Times. Archived from the original on 28 November 2022. Retrieved 24 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  9. Dafe, Daniel (23 January 2018). "Nigerian Cleric, Miyerijesu Gets N100M 2018 SUV Birthday Gift". Oasis Magazine. Retrieved 24 November 2023.
  10. "70 Years Birthday: Church Members Present N50m SUV To Warri Bishop, Miyerijesu". Urhobo Today. 24 January 2018. Archived from the original on 9 December 2021. Retrieved 24 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  11. "THANK YOU JESUS: A Poem On Bishop Daniel Dikeji Miyerijesu By Pastor Isaiah Oghenevwegba Ogedegbe". Blank Poetry. 4 August 2016. Archived from the original on 1 June 2023. Retrieved 24 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  12. Miyerijesu, Daniel Dikeji (2017). The Epistle of Saint Dikeji Daniel Miyerijesu to the Uromis. Warri. ISBN 978-033-671-0.

Extanal links[chenj-am | chenj-am for orijin]