Jump to content

Peter Palmer Ekeh

From Wikipedia

Peter Palmer Ekeh (dem bon am for August 8, 1937 and e kpai for November 17, 2020),[1][2] wey pipo sabi as Peter Ekeh, na di lait Naija soshologist and univasiti tisha. [3][4] [5] E bi profesor, di chairmo of di Dipatment of Politiko Sayens for di Univasiti of Ibadon (1978-1983) and di chairmo of di Ibadon Univasiti Pres (1983-1988).[1][4][5] E bi di Presido and chairmo of di Urhobo Historiko Sosaiti,[4][5] wey e stat for 1999 and becos of am "pipo go sabi Urhobo kolsho and histri mek e for nor los".[2] Na im stat di Naija Skolas for Dailog.[1] For 14 March 2023, Isaiah Ogedegbe tok say e si am as "one of Urhobo ogbonge skolas wey don show konsan about building im students and giving dem koret norlej of politiko sayens".[3] Bifor nau, dem don konsida am as "iroko tree for di fid of politiko sayens and soshologi".[1] Dem sabi am evriwie as beta raita, wit meni koret buks and atikuls wey e rait.[2][3][6] Him 1975 atikul: "Kolonialisim and di Two Pobliks for Afrika: A Theoretiko Stetment" na one of di most cited works for di fid of Afrikan, politiko and soshologiko studis for som univasitis all ova di world.[1][5][6] Dem rimemba am as a husband, papa, grandpapa, and skola.[7]

Pej wey konsan dis one

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. 1 2 3 4 5 "Tears As World Acclaimed Nigerian Scholar, Prof Peter Ekeh, Passes On At 83". Sundiata Post. 17 November 2020. Archived from the original on 17 June 2021. Retrieved 14 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 1 2 3 "Peter Palmer Ekeh, (1937 - 2020)". ForeverMissed.com. Archived from the original on 14 March 2023. Retrieved 14 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. 1 2 3 Ogedegbe, Isaiah (14 March 2023). "Professor Peter Palmer Ekeh: Urhobo's Greatest Scholar". Opinion Nigeria. Archived from the original on 14 March 2023. Retrieved 14 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. 1 2 3 "Urhobo Historical Society Loses Founder, Professor Peter Palmer Ekeh". Independent Newspaper. 28 November 2020. Archived from the original on 21 January 2021. Retrieved 14 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  5. 1 2 3 4 "Erudite Scholar, Peter Ekeh Dies". ThisDay Newspaper. 20 November 2020. Archived from the original on 20 January 2022. Retrieved 14 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  6. 1 2 Oyiborhoro, Sam (30 November 2020). "From humble beginnings to enviable heights". The Nation Newspaper. Archived from the original on 15 March 2023. Retrieved 15 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  7. "Professor Peter Palmer Ekeh: Urhobo's Greatest Scholar". LifeStyle.com.ng. 14 March 2023. Archived from the original on 14 March 2023. Retrieved 14 March 2023.