Jump to content

Rashidi Yekini

From Wikipedia
Rashidi Yekini
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemRashid Chenj-am
Famili nemYekini Chenj-am
Wen dem bon am23 October 1963 Chenj-am
Ples wey dem bon amKaduna Chenj-am
Wen e kpai4 May 2012 Chenj-am
Place of deathIbadan Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialityforward Chenj-am
Wen e stat wok1981 Chenj-am
End of work period2005 Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Eye kolordark brown Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Rashidi Yekini (dey bon am 23 October 1963 an e kpai on 4 May 2012) na Naija futbola wey dey play front posishon. Na Yekini score pass for all di futbola wey don play for Naija. Yekini play futbol for more dan 20 years. Na one klub kol Vitória de Setúbal wey de Portugal e yuz meni of e time play for. Yekini play futbol for oda klub wey de six kontri.

Di tota nomba of goal wey Yekini goal for Naija na 37. E dey for Naija futbol tim wey play for seven mejo kompetishon. Two Wold Kop join for di seven mejo kompetishon wey e play for Naija. Na Yekini score di fest eva goal wey Naija fest goal for di histri of Wold Kop. Wen CAF wan men futbola wey play pass for 1993 for Afrika Futbola of di year in 1993, na Yekini dey chuz.

How e tek play futbol

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yekini peret na Yoruba but na Kaduna dey tek bon am. E start to dey play in Naija Ligi bifor e kom go Ivory Coast go play for Afrika Sport Nashonal. From Ivory Coast, Yekini go Portugal go play for Vitória de Setúbal. Na for dat klub e rili play e best futbol. Yekini win di hiyest goal skoral awod for 1993-1994 Sisin in di Primeira Liga in Portugal. Na 21 goal wey e score mek am win di awod. Bifor di 1993-1994 sisin, Yekini helep e klub komot from sekod divishon kom Primeira Liga with e 34 goal wey e score in 32 game. Na dis one fit mek am win di Afrika best playa awod in 1993. Na Yekini bi di fest Naija playa to win dis awod.

In 1994, Yekini sahin for Olympiacos wey de Greece. Yekini blood no go with e tim playa an dis one mek am komot for Olympiacos. Yekini play for Sporting de Gijón wey de Spain bifor e kom bak to e forma klub Setúbal. Oda futbol klub wey Yekini play for na Zurich, Club Athlétique Bizertin, an Al-Shabab Riyadh bifor e kom bak to dey play Afrika futbol.

In 2013, Yekini join Julius Berger F.C wey de Naija for Nigeria Shampionship .Yekini join Gateway United FC wen e bi 41 years old on April 2005.

How e tek play futbol for e kontri

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yekini play 62 futbol game for Naija an e score 37 goal. Na e goal pass for Naija. Yekini de di Naija tim wey play 1994 Wold kup an e score Naija eva fest goal for Wold kup in di 3-0 win against Bulgaria. Wen Yekini score dat goal, e hapi sotey wota komot for e two eye. Di one mek pipo dey rimemba di Wold kup til todey.

Yekini dey di futbola tim wey win di 1994 Afrika Kop of Neshon wey hapun for Tunisia. For di kompetishon, na Yekini score di hiyest goal an na im bi di best playa for di kompetishon. Yekini dey di futbola tim wey go Olympic in Seoul 1988.

List of international goals scored by Rashidi Yekini
No. Date Venue Opponent Score Result Competition
16 April 1985Nairobi, KenyaTemplet:Fb3–01986 World Cup qualification
220 April 1985Lagos, NigeriaTemplet:Fb3–11986 World Cup qualification
323 June 1985Abidjan, Ivory CoastTemplet:Fb1–1Friendly
426 June 1985Bouake, Ivory CoastTemplet:Fb1–1Friendly
514 March 1988Rabat, MoroccoTemplet:Fb3–01988 African Cup of Nations
65 March 1990Algiers, AlgeriaTemplet:Fb1–01990 African Cup of Nations
78 March 1990Algiers, AlgeriaTemplet:Fb1–01990 African Cup of Nations
812 March 1990Algiers, AlgeriaTemplet:Fb2–01990 African Cup of Nations
927 July 1991Lagos, NigeriaTemplet:Fb7–11992 African Cup of Nations qualification
10
11
12
1314 January 1992Dakar, SenegalTemplet:Fb2–11992 African Cup of Nations
14
1519 January 1992Dakar, SenegalTemplet:Fb1–01992 African Cup of Nations
1625 January 1992Dakar, SenegalTemplet:Fb2–11992 African Cup of Nations
1710 October 1992Lagos, NigeriaTemplet:Fb4–01994 World Cup qualification
18
1920 December 1992Pointe-Noire, CongoTemplet:Fb1–01994 World Cup qualification
2024 April 1993Enugu, NigeriaTemplet:Fb2–11994 African Cup of Nations qualification
212 May 1993Abidjan, Ivory CoastTemplet:Fb1–21994 World Cup qualification
223 July 1993Lagos, NigeriaTemplet:Fb4–11994 World Cup qualification
23
2424 July 1993Lagos, NigeriaTemplet:Fb6–01994 African Cup of Nations qualification
25
26
2725 September 1993Lagos, NigeriaTemplet:Fb4–11994 World Cup qualification
28
2926 March 1994Tunis, TunisiaTemplet:Fb3–01994 African Cup of Nations
30
312 April 1994Tunis, TunisiaTemplet:Fb2–01994 African Cup of Nations
32
336 April 1994Tunis, TunisiaTemplet:Fb2–21994 African Cup of Nations
3411 June 1994Ibadan, NigeriaTemplet:Fb5–1Friendly
35
3621 June 1994Dallas, United StatesTemplet:Fb3–01994 FIFA World Cup
3722 February 1998Kingston, JamaicaTemplet:Fb2–2Friendly

How e tek kpai

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Niuz kari am sey Yekini dey sik for som time. In 2011, ripot for niuz tok sey e dey get smol smol kolo meat for head. Yekini kpai on 4 May 2012 for Ibadan. Na two of e forma futbola Mutiu Adepoju an Ike Shorunmu break di niuz. Dey beri Yekini for Ira, Kwara Stet. Na e house kompond dey beri am.