Oby Ezekwesili

From Wikipedia
Oby Ezekwesili
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejObiageli Ezekwesili Chenj-am
Fest nemObiageli Chenj-am
NameMadam Due Process Chenj-am
Wen dem bon am28 April 1963 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos State Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokIgbo langwej, English langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dueconomist, chartered accountant, politician Chenj-am
Wu e dey wok forTransparency International Chenj-am
Post wey e deyMinister of Education of Nigeria, Minister of Mines and Steel Development Chenj-am
Wie e go skulJohn F. Kennedy School of Government, University of Lagos, University of Nigeria Chenj-am
Candidacy in election2019 Nigerian presidential election Chenj-am
Awod wey e koletBBC 100 Women, OkayAfrica 100 Women, BBC 100 Women Chenj-am

Obiageli "Oby" Ezekwesili (dem bon am on 28 April 1963) na pesin wey ekonomik mata wel wel, shi lik mek tins dey kleer, shi lik tins dey gud for pipu an shi dey hep pipu wey no tu get.

Na shi bi bifor bifor vice president of Wod Bank Afrika region, shi dey insaid pipu wey stat Transperacy Internashonal, shi dey insaid pipu wey stat #BringBackOurGirls mata an shi don sarf two taims for Naija as Fediral Minista, na shi stat #Fixpolitics,di Skul of politis Policy an Governance (SPPG), an Human Capital Afrika.

Shi bi memba of di board of Direktors of Wumen Politika Leaders, na memba board of trustees Fundacao Dom Cabral, an di chairpesin of board Ehizua Hub.

Ezekwesili na chartered akountant, poblik analyst, an sinior ekonomik advisa fom Anambra Stet.

Hau e tek stat life an edukashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ezekwesili insaid Legos Stet to Benjamin Ujubuonu, wey kpai in 1988, an Cecilia Nwayiaka Ujubuonu.

Ezekwesili get bachelor's digre fom Universiti of Nigeria, Nsukka, masta digre in intanashonal lor an Diplomacy fom di Universiti of Legos, an Masta of Poblik Administrashon digre fom Havard Kennedy Skul for Havard Universiti. Deloitte an Touche train am wey mek am bi Chartered akountant.

Wen e wok for Government of Nigeria, Ezekwesili stil wok for Professor Jeffrey Sachs wey dey Centa for Intanashonal Divelopmet for Havard as do Direkto of di Havard-Nigeria Ekonomik Strategi Projet.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ezekwesili don sarf as federal Minista of Solid an Minerals an leta as Federal Minista of Edukashon. Shi don sarf as di Vice president of di Wod Bank Afrika region fom May 2007 rish May 2012, na Makhtar Diop, replas am for dia.

Na sinior fello for Yale Jackson School of Global Affairs.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Pastor Chinedu Ezekwesili of di Redeemed Christian Chorch of God (RCCG) shi mari and dey get three pikin wey; Chinemelum, Chinweuba and Chidera.

In April 2021, Ezekwesili rait polis pipu sey mek dem hep am tel Japhet Omojuwa, mek e no dey uze im n for dia kompini, Alpha Reach Company Limited, as direkto.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

‌In 2006, dem giv Ezekwesili nashonal awod of Commander of di Order of di Fediral Repoblik of Nigeria (CFR).

.‌‌In May 2012, dem giv Ezekwesili honorary Doctor of Science (DSC) digre fom Universiti of Agriculture, Abeokuta insaid Nigeria. Shi dey insaid BBC's 100 Women in 2013 an 2014.

.‌‌In December 2012, Ezekwesili nem dey insaid 100 most influential Afrikas.

‌.In March 2016, Ezekwesili win 2016 New Afrika Women Awods.

.‌‌In July 2016, dem giv am honorary graduate digre by University of Essex, United Kingdom.

.‌‌In March 2019, Ezekwesili win Forbes Women Afrika Social Influencer Awod bikos hau shi tek di #BringBackOurGirls campaign.

‌.In 2019, dem giv am Awod of Richard Von Weizsäcker Fellowship at di Robert Bosch Academy in Berlin.

‌.Shi dey insaid pipu dey selet as Global Leadership Awords honoree.