MohBad

From Wikipedia
MohBad
pesin
Part of27 Club Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
AliasMohbad Chenj-am
Wen dem bon am3 January 1996 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos, Ketu Chenj-am
Wen e kpai12 September 2023 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician Chenj-am
Wen e stat wok2019 Chenj-am
Work period (end)2023 Chenj-am
Instrumentvoice Chenj-am
Significant eventDeath of MohBad Chenj-am

Ilerioluwa Oladimeji Aloba (dem bon am on 3 January 1996 an e kpai 12 September 2023), wey plenti pipu sabi as MohBad, na Naija rappa, singa an songraita from Legos. E sahin for Naira Marley Marlian rekods an leta komot for di label in 2022. Song wey dem yuz sabi am wel wel na Ponmo, Feel Good, an "KPK (Ko Por Ke)" (You will always be remembered) wey e du with Rexxie wey mek am di song dey di katigori of song wey fit win Headies for 2022.


For Septemba 21, 2023, Niran Adedokun bin rait sey MohBad "get ogbonge talent and e dey in tune with di veri spirit of musik".[1] While a Naija relijos figor and blogga, Isaiah Ogedegbe, don also tok sey MohBad na "one of di ogbonge rapas for di whole world". [2][3][4]

[5]

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ilerioluwa Oladimeji Aloba for Ketu, Legos Stet, Naija.

How e tek du im muzik wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

MohBad fest wok na Light, wey e du afta e rilis Ponmo, Naira Marley an Lil Kesh sef sing inside di song. MohBad nem don sho five time for di katigori of singa wey fit win The Beatz Awards 2021.

MohBad dey inside AudioMack's top 21 Afrobeat singa of 2021. In 2022 e rilis Peace, wey Rexie hep am produs. E rish top for Turn Table Chart top 50 in 2021 an top 100 in 2022. Peace rekod dey for nomba one for Apple Music Chart Nigeria.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

MohBad an im wife, Wunmi bon one pikin. MohBad kpai afta e go hospitu wen e no wel on 12 September 2023, wen e dey 27 years old. Polis tel pipu sey dem go find wetin kil am, wey mek dem go komot e bodi wen dem don beri for on 21 September.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

EPs

.Light (2020) .Blessed (2023)

<sup singles

Caption text
Year Title
2021 "Feel Good"
2021 "Backside"
2022 "Weekend"
2022 "Til"
2022 Peace
2022 Halleluyah
2022 Ronaldo

Awods an norminashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

The Beatz Awards (2021): five nominashons


Audiomack (2021): top 21 Afrobeat artists of 2021.

Headies Award Nomination (2023): Best Street-Hop Artist.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Adedokun, Niran (21 September 2023). "Nigeria failed Mohbad". Punch Newspapers. Archived from the original on 23 September 2023. Retrieved 24 September 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. Ogedegbe, Isaiah (24 September 2023). "Mohbad: The Story of Ilerioluwa Oladimeji Aloba -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Archived from the original on 24 September 2023. Retrieved 24 September 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. "The Story of Ilerioluwa Oladimeji Aloba -By Isaiah Ogedegbe". Fire News. 24 September 2023. Archived from the original on 25 September 2023. Retrieved 25 September 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. "Mohbad: The Story of Ilerioluwa Oladimeji Aloba -By Isaiah Ogedegbe". NG Gossips. Archived from the original on 2023-09-25. Retrieved 2023-09-25.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  5. "Mohbad: The Story of Ilerioluwa Oladimeji Aloba -By Isaiah Ogedegbe". Nigerian Times. 24 September 2023. Archived from the original on 4 November 2023. Retrieved 11 November 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)

External links[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. MohBad Biography Itodo NR, September 15 2021.

2. Zinoleesky and Mohbad: NDLEA arrest Naira Marley signees say dem allegedly dey wit molly and cannabis BBC News, 24 February 2022.

3. Police Invited Sam Larry MohBad failed to show up. Punch Newspaper, September 14 2023.