Kudirat Kekere-Ekun
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Kudirat |
Wen dem bon am | 27 February 1958, 7 May 1958 |
Ples wey dem bon am | Lagos |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | jurist, judge |
Post wey e dey | Chief Justice of Nigeria, Justice of the Supreme Court of Nigeria |
Wie e go skul | London School of Economics and Political Science, University of Lagos, Nigerian Law School |
Academic degree | Bachelor of Laws, Master of Laws |
Honorific prefix | Order of the Federal Republic |
Country calling code | +234 |
Kudirat Motonmori Olatokunbo CFR(dem bon am on May 1958), plenti sabi am as Kudirat Kekere-Ekun, na Naija pesin wey sabi lor wel wel an jostis of di Supreme Court of Nigeri wey don sarf as di Chief Jostis of Nigeria sins 22 August 2024. Na shi dey as Chief Jostis of Nigeria afta Cheif Jostis Olukayode Ariwoola.
How e stat life an edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Kekere Ekun for London, United Kingdom on 7 May 1958. In 1980, shi kolet bachelor's digre in Lor fom di Universiti of Legos an shi enta Nigeria Bar on 10 July 1981, afta shi finish for Nigeria Lor Skul shi kon stil go London Skul of Ekonomiks wia shi kolet Masta's digre in Lor in November 1983.
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]Insaid October 2022, President Muhammadu Buhari giv am Nigerian nashonal honor of Commander of di Order of di Fediral Repoblik (CFR).
Lor wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi don wok for Legos Stet Judiciary as Sinior Magistrate II an shi rish posishon of di Stet High Court Jorj. Shi sarf as Chairman of Robbery an Firearms Tribunal, Zone II, Ikeja insaid November 1996 to May 1999. Dem apoint am to bench of the Nigerian courts of appeal in 2004 bifor dey apoint am as Jostis of di Supreme Court of Nigeria in July 2013. In 2020, shi dey insaid pipu wey Dem selet as seven- memba panel wey komot Imo State governor Emeka Ihedioha kon put Hope Uzodinma of di All Progressives Congress (APC), wey kari fourth wen dey anous di eleshon risot.