Olukayode Ariwoola
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Wen dem bon am | 22 August 1958 |
| Ples wey dem bon am | Iseyin |
| Fest langwej | Yoruba Langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | lawyer |
| Post wey e dey | Chief Justice of Nigeria |
| Wie e go skul | Obafemi Awolowo University |
| Academic degree | Bachelor of Laws |
Olukayode Ariwoola GCON (dey bon am 22 August 1954) na forma Naija lorya wey don wok as sinior lorya insaid Suprim Kot of Naija. Ariwoola don wok as di shif jostis of di Fediral Riploblik of Naija fom 2022 go rish 2024. Bifor e bikom di shif jostis of di fedireshon, e don wok as lorya of di Naija kot of apiiee. Na on di 22 November 2011 na im dey kol Ariwoola mek im kom join dem dey wok for suprim kot of Naija. Na on 27 June 2022 na im dey mek Awarioola pamanet shif jostis of suprim kot of Naija afta Tanko Muhammad risain. Tanko Muhammad bi di shif jostis wey Ariwoola tek ova fom bot na on di 21 September 2022 di Naija sinet konfam am as di niu shif jostis of di fedireshon.
Hau e tek stat laif an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Iseyin wey de Oyo Stet dem tek bon Ariwoola. Ariwoola go Lokal Ortoriti Demosireshon Skul, wey de Oluwole in Iseyin lokal govamet aria of Oyo Stet for im pamari edukeshon. For im sekondri edukeshon, e fest go Muslim Modern Skul wey de Iseyin fom 1968 go rish 1969 bifor e chenj skul to Ansar-Ud-deen Hi-Skul Shaki, wey de Oyo Stet. Na for Ansar-Ud-Deen Ariwoola tek finish im sekondri edukeshon.
Hau e tek wok as lorya
[chenj-am | chenj-am for orijin]Afta Ariwoola finish im Yunivasiti edukeshon, e kwulifa-e to dey wok for Naija kot for July 1981. Na sem yie, e stat to dey wok insaid Suprim Kot of Naija as lorya wey de du smol smol wok for kot like to dey giv advais to pipul wey get kes for kot, to dey kari kes mata to di barista-dem. Ariwoola kom stat im wok as lorya wen e stat to dey wok as di lorya wey dey giv Stet advais on mata wey konsain NYSC (Nashonal Youth Sarvis Corps) at di Minista of Jostis wey de Akure, for Ondo Stet. Leta, e kom bikom di Legal Ofisa insaid di Ministri of Jostis, wey de Oyo Stet ontil 1988. Afta 1988, Ariwoola by imsef risain fom govamet wok an stat to dey wok for pipul. Ariwoola don wok as lorya for di lo ofis of Shif Ladosu Ladapo (SAN) bitwin October 1988 go rish July 1989. Afta dat yie, Ariwoola go fom Olukayode Ariwoola & Co., one lo ofis wey de Oyo Stet. Na August 1989 e fom dis lo ofis. Na dia Ariwoola dey wok ontil dem mek am Joj of Oyo Stet Kot mata on November 1992. Ariwoola don wok as di sha-man of Board of Daretor, Phonex Motors Ltd., wey bi one of di smol smol kompini dem wey Oodua Investment dey kontro bitwin 1988 go rish 1992. Ariwoola don du sha-man for di panel for Armed Robba wey Oyo Stet arenj bitwin 1993 go rish September 1996 wen dem kari komot f hed-kwutas Ibadan, go Saki Hi-kot. Bifor Ariwoola get di hi posishon to bi shif jostis of di fedireshon, e don wok as oga patapata lorya wey konsain apilee in Kaduna, Enugu, an Legos divishon.
Difren difren komiti wey e de
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Memba of Naija Bar Asosiashon
- Memba of Intanashonal Bar Asosiashon
- Memba of Naija Bodi of Benchers
Nashonal onos
[chenj-am | chenj-am for orijin]Forma presidor Muhammadu Buhari on October 2022 giv Ariwoola di GCON (Grand Commander of th e Order of the Niger) tahitu .
For 11 June 2024, FRSC giv Ariwoola wey di nem na Spesha Marshall
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]1. Full list Okonjo Iweala, Abba Kyari...FG nominates 437 persons for national honours. The cable. 2 October 2022. Retrieved 29 November 2023.
2. Justice Tanko Muhammad resigns as CJN. Punch Newspaper, 27 June 2022. Retrived 29 November 28 2023