Jimoh Ibrahim

From Wikipedia
Jimoh Ibrahim
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am24 February 1967 Chenj-am
Ples wey dem bon amOndo State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, entrepreneur, lawyer Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulHarvard Law School, Obafemi Awolowo University, Harvard University Chenj-am
Wie e dey livLagos Chenj-am
E pipul Chenj-am

Jimoh Ibrahim (Dem bon am on 24 February 1967) na Naija lorya, politishan, biznesman an na Senator wey dey stand for Ondo South Senatorial District sins 2023.

Na im bi di chairman an chief exekutiv ofisa of Global Fleet Group, wey bi big compini for Nigeria, an still get koneshon wit som West Afrika kontris. Insaid July 2022, dem giv am profeshona Biznes Doctorate (BusD) by di Universiti of Cambridge, United Kingdom.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ibrahim stat life for Oyo Stet, wey dey southerwestern Nigeria. E stodi lor for Obafemi Awolowo University wey dey Ile - Ife, Osun Stet, Nigeria, wit digre of Bachelor laws (LLB). E get digre in Master of Poblik Administration (MPA) fom di sem Universiti. E kon leta go Havard University, wey dey Cambridge, Massachusetts, USA. E finish for di skul wit Master of Laws (LLM) an Master in International Taxation digre. E dey du Oil an gas biznes, hotels, banking, Land biznes, an e lik to dey put moni for biznes wey go giv am beta gain.

Som oda biznes e dey du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Global Fleet Group get subsidiary companies, like:

Air Nigeria - Lagos, Nigeria - bifor bofor Virgin Nigeria

NICON Insurance - Lagos, Nigeria

Nigeria Reinsurance Corporation - Lagos, Nigeria

NICON Luxury Hotel - Abuja, Nigeria - bifor bifor Le' Meridien Hotel.

Global Fleet Oil & Gas - wey bi pat of gasoline stations (estimated at about 200 in 2011), akros Nigeria

Di NICON Group - Lagos, Nigeria - Holdings wey still get investment companies, schools, real estate holdings, transport compinis and odas

Global Fleet Building - Lagos, Nigeria - bifor bifor Allied Bank Building

Meidan Hotel - Lagos, Nigeria

Global Fleet Industries - Lagos, Nigeria - bifor bifor HFP Industries Limited

Energy Bank - Accra, Ghana - niu bank in Ghana, stat to dey operatr in February 2011 Oceanic Bank São Tomé - São Tomé, São Tomé and Príncipe - Bank wey dem buy fom Oceanic Bank in May 2011. Newswatch Magazine - Lagos.

Oda tins wey e dey du[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2003, Jimoh Ibrahim trai to enta as govnor of Ondo Stet, onda All Nigeria People Party (ANPP) e no win. E don rait three buks. E mari Mrs Modupe Jimoh Ibrahim an na papa for four pikin. Na poblisha of Nashonal Mirror Newspaper wey dey Naija.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Jimoh Ibrahim wins Ondo South Senatorial seat. Daily Nigerian, 27 February 2023.

2.Nigerian Jimoh Ibrahim Takes over Oceanic Bank Sao Tome. Daily Independent (Lagos). 23 May 2011. Retrived 3 December 2023.