Jump to content

Jerry Eze

From Wikipedia
Jerry Eze
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemJerry Chenj-am
Famili nemEze Chenj-am
Wen dem bon am2 August 1982 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbia State Chenj-am
Pesin wey e mariEno Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej Chenj-am
Wok wey e dey duraita, evangelist, pastor Chenj-am
Pat of wok wey e put mindHistory and International Relations: From the Ancient World to the 21st Century Chenj-am
Wie e go skulAbia State University Chenj-am
Work locationAbuja Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Jerry Uchechukwu Eze (dem bon am 22 August 1982) na Naija pasto wey bi di fonda of Streams of Joy International Church. Na Eze bi di lida of NSPPD ( New Season Prophetic Prayers and Declaration ). NSPPD na one online preya mitin platform.

How e tek start life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Eze on di 22 August of 1982 in Umuahia, Abia Stet. Umuahia bi di kapita of Abia Stet. Eze kom from Okoko Item, Bende Lokal Govamet Aria of Abia Stet, Naija. Eze go Ibeku hi-skul Umuahia for im sekondri skul edukeshon. E enta di skul in 1991 an finish dia in 1997. Eze go Abia Stet Yunivasiti go rid Histri an Intanashonal Rileshonship. E leta go ESUT ( Enugu Stet Yunivasiti of Tekinoloji) for e post- graduate edukeshon wie e rid Bizness Hadimistreshon.

How e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eze don wok bifor for World Bank Project for mata wey konsain HIV/AIDS an for UNFPA (Yunated Neshon Populeshon Fund). Eze wok for dia na to dey spik about mata wey konsain HIV/AIDS.

How e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eze don wok bifor for World Bank Project for mata wey konsain HIV/AIDS an for UNFPA (Yunated Neshon Populeshon Fund). Eze wok for dia na to dey spik about mata wey konsain HIV/AIDS. Eze kom leta bikom pasto

Eze wife na pasto Eno Jerry. Dia marej produs two pikin.

How e tek start e pasto wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eze start im pasto wok in 2009 wen e stil dey go All Saints Chapel. In 2013, e mek e own chorch an e nem am Stream of Joy International Church. Di chorch dey Abia Stet an na im bi di big pasto for dia. By November 2022, Eze chorch, Streams of Joy don dey ova 13 aria for Naija, Kanada, US, an for United Kingdom.

Na how pipo fit get mirakul e chorch dey put as nomba one. Eze like to dey tok one word wey bi Wetin God no fit do no de.

Wen Covid-19 start, Eze start to dey yuz intanet dey tok about e ministri. Na dat time e form NSPPD (Di New Sisin Profetik Preya an Diklareshon). Na for YouTube an oda sosha midiha e dey yuz to fit rish pipo. UNa million of pipo dey lisin to dis program.

Buk-dem wey e don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Streams of Joy Daily Devotional (Best Seller)
  • Supernatural Parenting
  • Am I making a mistake?
  • My Night Thoughts Volumes 1-4
  • Resplendent Relationships