Dorcas Shola-Fapson

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Dorcas Shola-Fapson
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromUK Chenj-am
Wen dem bon am4 January 1991 Chenj-am
Ples wey dem bon amLondon Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Bedfordshire, University of Lagos Chenj-am
Wen e stat wok2016 Chenj-am

Dorcas Shola Fapson na pesin nem for Naijá we de akt fim an i stil de tok for difrent sho. Dem no am for di pat we im akt as 'Sophie' for Shuga wey MTV dey do. I go bak go kontinu di MTV shuga for 2020 bikos i konsain coronavirus mata an na difrent pipu for plenti kontri for Afrika join akt dis wan.

im Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Fapson for London for inside 1990s. Im mama kpai wen i dey 14 yez an im get im fest digri for England as pesin we len how pipu tek dey do kraim. I kom stil go len as pipu tek dey akt fim for New York.

I don akt plenti plenti pat as 'Sophie' for Shuga wey MTV dey do an i kom bi di pesin we dey tok for NdanTv sho wey dem dey kol "The Juice".

I folo akt for di pat 3 for MTV shuga an i go bak go kontinu as dokto as "Sophie" for di taim wey di tin kom bi smol-smol pat we dem dey kol MTV Shuga Alone Together we rili tok abaut di wahala wey coronavirus kos for 2020. Na Tunde Aladese rait am an na for difrent-difrent nait dem sho am an United Nations sopot am. Na for Naijá, South Africa, Kenya and Côte d'Ivoire dem akt di fim and di tori waka rish where dem kom dey tok for onli fone at am. Som of di pipu we akt di fim na Mohau Cele, Lerato Walaza, Sthandiwe Kgoroge, Uzoamaka Aniunoh, Mamarumo Marokane an Jemima Osunde.


Som fim we i don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

●Banana Island Ghost (2017)

●My Wife & I (2017)

●The Essence (2019)

Televishon

●Shuga (season 3): Shuga Naija (2013-2014, 2020)

●‘‘Castle & Castle ‘‘(2019-2021)

Yu stil fit chek[chenj-am | chenj-am for orijin]

●List of Yoruba people