Bisi Komolafe
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Nem for lokal langwej | Bisi Komolafe |
Orijina nem | Bisi Komolafe |
Wen dem bon am | 1986 |
Ples wey dem bon am | Ibadan |
Wen e kpai | 31 December 2012 |
Cause of death | puerperal disorders |
Fest langwej | Yoruba Langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | actor, film director, film producer |
Wie e go skul | Lagos State University |
Wen e stat wok | 2008 |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Personal pronoun | L484 |
Bisi Komolafe(1986-2012) na naija aktres,fim dairekto an produsa, wey dem no for ha pley for di from Igboro Ti Daru an Aramotu
Bisi Komolafe
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ha ful nem na Bisi komolafe Veronica an dem bon ha for 1986 for Ibadan,Oyo stet. Shi die for December 31 2012 for Univasiti kolej hospitu for Ibadan.
How shi tek stat life an ha skul mata
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bisi Komolafe na sekon pikin wey dem bon for 1986 insaid di famili wey get five pikin for Ibad,Oyo stet for Nigeria, na for their shi du ha primari an sekondri skul. Di school nem bi Saint Lois Grammar Skul" bifor shi go Legos stet univasiti(LASU) wia Shi finish wit a digri for Biznes Administreshon.
Karier
[chenj-am | chenj-am for orijin]Pipul no Bisi wela for di fim wey dem kol Igboro ti daru.shi kon leta du lidin role for plenti plenti fim like Bolode oku, Asiri Owo, Ebute. Bisi olso produs fim like Latonwa, Eja tutu, an Oka. Dem nominet am for Revelashon of di year Katigori for 2009 best of noliwud awods an for best lid aktress for Yoruba fim katigori for 2012 edishon.
How shi tek kpai
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bisi kpai for Desemba 31, 2012.Doktor an test tok sey na pregnant palava na im kil ha for univasiti kolej hospitu, Ibadan. Dem beri ha for January 4, 2013 for Ibadan.
Som fim wey shi du
[chenj-am | chenj-am for orijin]°Igboro To Daru
°Aye Ore Meji
°Apere Ori
°Omo Olomo Larin Ero
°Jo kin Jo
°Akun
°Bolode O'ku
°Aramotu
°Asiri Owo
°Ogbe Inu
°Ayekooto
°Latonwa
°Alakada
°Mofe Kayo
°Ebute
°Iberi Bojo
Pasona life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Shi mari canadian wey dey stey Naiija man, wey im nem na Tunde Ijadunola for Oyo stet.
References
[chenj-am | chenj-am for orijin]http://www.vanguardngr.com/2013/01/nollywood-actress-bisi-komolafe-for-burial-in-ibadan-tomorrow/