Bianca Odumegwu-Ojukwu
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Bianca, Olivia |
Wen dem bon am | 5 August 1968 |
Pesin wey e mari | Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu |
Fest langwej | Igbo langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej, Naijá langwej |
Wok wey e dey du | diplomat, lawyer, beauty pageant contestant, businessperson |
Wie e go skul | University of Nigeria, University of Buckingham, Universidad Alfonso X el Sabio, Nigerian Law School, Ackworth School |
E pipul | Igbo pipul |
Victory | Most Beautiful Girl in Nigeria, Miss Africa Queen, Miss Intercontinental |
Bianca Odumegwu-Ojukwu (e papa nem bifor e mari na Onoh, an dem bon am 5 August 1968) na Naija wuman wey bi politishian, lorya, bizness wuman, an pesin wey don win meni beuti fashon awod. Bianca na di wife of Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu wey don kpai. Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu na di forma presidor of Biafra. Bianca don kari fest in meni beuti fashon show like: Di Most Beutifu Gel in Naijira (MBGN), Miss Afrika, an Miss Intakotineta. Bianca don wok as pesin wey dey advais Naija presidor in some mata. Im don do Ambasedor as Naija pesin to Ghana. In 2012, Naija govamet pik Bianca as dia Ambasedor to Spain.
How e tek start life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bianca papa nem na Christian Onoh an e mama nem na Carol Onoh. Christian Onoh bi di forma govanor of Anambra Stet. Bianca mama, Carol Onoh don wok as kolej prisipa bifor. Na six pikin e peret bon: Lilian, Josephine, Nuzo Gabriel, Stella, Christian, Joseph, an Bianca imsef. Na Bianca bi di las bon of di famili. Bianca go Ackworth skul, Pontefract, St Andrews Kolej, Cambridge, an Cambridge Tutorial Kolej wia e tek rait e A-Level ezam. Bianca leta enta Yunivasiti of Buckingham to go rid Politis an Ekonomik. Bianca papa, Christian Onoh wey bi lorya imsef wan mek Bianca bikom a lorya so dat e go fit tekia of di famili bizness leta. Bianca leta go Nigeria Law School an e leta kwulify to bikom a lorya.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na smol time Bianca tek wok as lorya bifor e faze oda tins for im life like im marej, lm fashon bizness wey e nem Bianca Blend, an e dekoratin bizness Mirabella. Bianca fom one organaseshon kol Hope House Trust. Dis Organaseshon na to helep smol smol pikin-dem wey dey korse trobul for Enugu Stet.
Awod wey e don kolet as model
[chenj-am | chenj-am for orijin]- In December 1988, Bianca kari fest as Miss Martini
- In 1988, e kari fest in Most Beutifu Gel in Naijira
- In 1989, e kari fest in Miss Afrika. Na for Gambia dey tek do di program
- In 1989, e win Miss Intakotineta. Dis win mek Bianca di fest eva Afrika wuman to win Miss Intakotineta.
How e tek wok for e kontri
[chenj-am | chenj-am for orijin]Forma presidor of Naija, Good luck Jonathan chuz Bianca as Sinior Spesha Hasistas on mata wey konsain forin tins in 2011. For 2012, Bianca bikom Naija Ambasedor to Ghana an leta e bikom Ambasedor to Spain. Presidet Bola Ahmed Tinubu chuz Bianca to bi Minista of Stet for mata wey konsain forin tins. Na on di 23 October 2024 dem give am dis wok to do. Na Bianca dey go for Naija wen United Nations World Tourism Organization wan do somtin for now.
E pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bianca hosband na Ikemba Odumegwu-Ojukwu. Di marej las onti e hosband kpai in 2011. Dia marej produs three pikin