Ayra Starr
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Benin |
| Nem for lokal langwej | Sarah Oyinkansola Aderibigbe |
| Orijina nem | juju, Grace Matango |
| Fest nem | Sarah |
| Famili nem | Aderibigbe |
| Alias | Ayra Starr |
| Wen dem bon am | 14 June 2002 |
| Ples wey dem bon am | Cotonou |
| Broda an sista | 4 |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, French, Yoruba Langwej, Beninese |
| Wok wey e dey du | singer-songwriter, singa |
| Pat of wok wey e put mind | composed musical work, music industry |
| Wen e stat wok | 2018 |
| E pipul | Yoruba pipul |
| Rilijon | Christianity |
| Hair kolor | black hair |
| Eye kolor | brown |
| Instrument | voice |
| Stai of song abi fim | African popular music, Nigerian hip hop, alté, contemporary R&B |
| Record label | Mavin Records |
| Nominated for | African Entertainment Awards USA, MOBO Awards |
| Official website | https://ayrastarr.com/ |
| Personal pronoun | L484 |
Oyinkansola Sarah Aderibigbe ( dey bon am 14 June 2002) wey pipo no wel wel as Ayra Starr na Naija muzikshan wey dem bon for Benin. Wen Ayra Starr dey 16 year old, e fest start to dey do fashon with Quove Model bifor e kom enta muzik. Ayra Starr fest dey sing di song wey oda pipo don sing for Instagram, but leta rilis e sing for Instagram in December 2019. Dis tin wey e do mek Don Jazzy see am an sahin am to e rekod lebel kompini Mavin Rekod. Pipo start to dey no Ayra Starr in 2021 afta wey e rilis one rekod with e nem. Di rekod get one song away wey pipo like wel wel. Di song "away " dey for gud two week as nomba 4 for Naija TurnTable Top 50 Chart. "Away" stil rish nomba 17 on di "Billboard Top Triller Global Chart". Ayra Starr rilis e komplit tape in 2021 with di nem 19 & Dangerous.
Ayra Starr muzik na Afropop an R & B. One of di song wey dey di habom Bloody Samaritan rish nomba 1 for Top 50 Chart mekin Ayra Starr di fest fimeli muzikshan wey e muzik wan rish nomba 1 in Top 50 Chart . Pipo start to no Ayra Starr intanashonal in 2022 wen e rilis di song Rush. Di song enta meni Billboard for Switzerland, Ireland, an di United Kindom. For United Kindom , di song rish nomba 24. Rush, mek Aura Starr bi di fest yongest Afrika Fimeli Singa to mek a song vidio wey ova 100 Million pipo go luk for YouTube. Ayra Starr still bi di fest Naija fimeli singa wey e song wan rish nomba 1 on UK offishal singu chart.
How e tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Cotonou, Benin dey tek bon Ayra Starr on 14 June, 2002. Ayra Starr gro up in Lagos, Naija. Ayra Starr peret kom from Kwara Stet an e peret bon five pikin.
Ayra famili like muzik wel wel an e start to dey like muzik wen e de 10 year old. Ayra Starr de pat of sekondiri skul studet wey dey sing. E sef dey join e broda to rait muzik.
Ayra Starr go Les Cours Sonou Yunivasiti an e get Bashelor Digree in intanashonal rilashon an politikal sayens. Ayra Starr tok sey bikos of meni pipo wey dey distop am wen e dey go Yunivasiti bikos of sey e smol for bodi, e dey alway lisin to Nicki Minaj wen e dey go Yunivasiti. Ayra Starr mama rili sopot e pikin wen Ayra Starr chuz to bi a singa.