YouTube

From Wikipedia

YouTube na one intanet online websait wie pipo fit put dia vidio for evribodi to luk am. Na San Bruno, for Kalifonia in Amerika dia hed-ofis de. YouTube stat to de wok for intanet on February 14, 2005. Di three pipo wey form YouTube bi: Steve Chen, Chad Hurley, an Jawed Karim. Di ona of YouTube bi Google an YouTube bi di sekod intanet websait wey pipo dey go pass. Na Google Search kari nomba one for di websait wey pipo dey go pass. Di nomba of pipul wey dey go YouTube evri month pass 2.5 billion. All dis pipo dey yuz ova 1 billion hours dey luk vidio wey de YouTube evri day. As of May 2019, for one minute, na vidio wey rish 500 hours dey enta YouTube. Google pay $1.65 billion to tek ova YouTube in October 2006.Kompini dey yuz YouTube tok abaut dia bizness wey oyinbo pipo dey kol advatais. Afta wen Google don tek ova YouTube, dem kom stat to dey give pipo wey dey put fims or muvee vidio to di websait some moni. Youtube get one ofa wey bi YouTube Premium. Dis ofa bi sey pesin fit pay moni if e no wan dey see advatismet as e dey luk tins for YouTube. Wen dey kount di moni wey enta YouTube poket in 2022, na $ 29.2 billion. In 2021, di moni wey enta dia poket na $28.8 billion.

Afta wey Google buy YouTube, Google mek suo sey YouTube fit de for fone, fit de some televison netwok an fit de some oda platfom wey e no de bifor. For YouTube, meni katigori of vidio de, like: Muzik vidio, Vidio klip, smol smol fims, Niuz, Vlog, an meni odas . Na pipo like me an you dey put plenti vidio wey we dey see for YouTube. Some vidio de wey bi sey na Kompini an some pipo wey bi YouTuber put dem. Meni big big kompini wey dey do fims like Disney, Paramount, NBCUniversal, an Warner Bros.Discovery don get dia own shanel for YouTube so dat dey go dey yuz am advatais.