Akinwunmi Adeshina

From Wikipedia
Akinwunmi Adeshina
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejAkinwumi Adesina Chenj-am
Famili nemAdesina Chenj-am
Official nameAkinwumi Adesina Chenj-am
Wen dem bon am6 February 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amOgun State Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dueconomist, politician, civil servant Chenj-am
Wie e go skulPurdue University, Obafemi Awolowo University Chenj-am
Affiliation stringFederal Ministry of Agriculture and Rural Development of Nigeria, African Development Bank (AfDB), African Development Bank Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Awod wey e koletWorld Food Prize Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Akinwunmi Akin Adeshina na Naija economics wey dey sarf as President of Africa Development Bank. Na im bi bifor bifor Naija Minista of Agriculture an Rural Development. Bifor e enta as Minista in 2020, na im bi di Vice president of policy an partnership for di Alliance for a green Revolution in Africa (AGRA). Na im dem vote for as di President of Africa Development Bank in 2015 an e enta for sekond time in 2020. Na im bi di fest Naija man wey go bi di President for di plez.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeshina papa an mama na farma an na for Ibadan Oyo State, dem bon am. E go vilaj skul an get digre in Agricultural Economics with Fest klass Honors fom di University of Ife (wey kon bi Obafemi Awolowo University nau), Nigeria in 1981. Na im bi di fest pesin wey dem go giv distinction for di Univasiti. E go anoda skul for Purdue University, Indiana an kom Nigeria bak in 1984, to mari. E get Ph.D in Agricultural Economics in 1988 fom Purdue, wia e tek get ph.D.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fom 1990 to 1995, Adeshina sarf as sinior economist at West Africa Rice Development Association (WARDA) in Bourké, Ivory Coast. E wok for Rockefeller Foundation. Fom 2003 to 2008, na im bi di associte director for food security.

Na Adeshina bi di Nigeria Agriculture Minista fom 2010 to 2015. Na Adeshina bi Afrika forbes Man of di Year. bikos of e tek arenj Naija Agriculture. E mek farmas ci fertilizer fas.

In 2010, United Nations Secretary General, Ban Ki-moon, as one of di 17 global leaders, to hep dem for Millennium Development Goals.

On 28 May 2015, na Adeshina bi di President of di Africa Development Bank. E stat d posishon for ofis on 1 September 2015.

In September 2016, Bank ki Moon, wey bi president of United Nations Secretary General, selet Adeshina to sarf as memeba of Lead Group of di Scaling Up Nutrition Movement. In 2007, e win 2017 Wod Food Prize.

On August 2020, Adeshina enta sekond term as President of di Africa Development Bank for five years.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Adeshina dey Prudence Universiti, Adeshina an im waif wit anoda pipu, stat di Africa Student Fellowship. Im an im waif, Grace get two pikin, Rotimi an Segun.

Hau dem tek sabi am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adeshina dey insaid top 100 influencial Africans by New Africa Magazine in 2005.

In 2013, na im bi di forbes Africa Person of the year.

In 2018, e get awod of Honorary Doctorate of Science by di Federal University of Agriculture, Abeokuta Nigeria.

On May 14 2022, e get awod of Honorary Doctor by Addis Ababa University, Ethiopia, on top of hau e tek wok for Economics.

Honors[chenj-am | chenj-am for orijin]

2019: Grand Officer of di National Order of Merit of Tunisia.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Africa Bank Development

2.This is Africa 30 July 2013.