Abiola Ajimobi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Abiola Ajimobi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejIsiaka Abiola Adeyemi Ajimobi Chenj-am
Orijina nemIsiaka Abiola Adeyemi Ajimobi Chenj-am
Fest nemAbiola Chenj-am
Wen dem bon am16 December 1949 Chenj-am
Ples wey dem bon amIbadan Chenj-am
Wen e kpai25 June 2020 Chenj-am
Place of deathLagos Chenj-am
Manner of deathnatural causes Chenj-am
Cause of deathmultiple organ dysfunction syndrome Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Oyo State, member of the Senate of Nigeria Chenj-am
Wie e go skulUniversity at Buffalo, Governors State University Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress, Alliance for Democracy Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Medical conditionCOVID-19 Chenj-am
Bifor amChristopher Alao-Akala, Peter Olawuyi Adeyemo Chenj-am
Replaced bySeyi Makinde, Kamorudeen Adekunle Adedibu Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Senator Isiaka Abiola Adeyemi Ajimobi (dem bon am for December 16, 1949 an e kpai for June 25, 2020) na Naija politishian wey kom fom Oyo State, sauth-west of Naija. Im na bifor bifor oga kpatakpata for National Oil and Chemical Marketing Company wey dey onda di kompini wey Shell Petroleum, Nigeria dey kontrol.Ajimobi ritaya komot for orye mata for 2002 afta 26 years of koret savis an e kom kontest an win eleshion go senate to repisent Oyo South Senatorial District on top di platfom of Alliance for Democracy (AD) party. Afta Ajimobi finish one term for senate, e kom join kolet gofnorship fom in 2007 wen e kontest bot e no win di gofnorship eleshion for Oyo Stet onda di parti of di All Nigeria People's Party. Ajimobi kontest again insaid di April 2011 gofnorship eleshions onda di Action Congress of Nigeria an dis taim e kom win di eleshion na so e tek bi di gofnor of Oyo Stet. Afta Ajimobi du two terms as gofnor fom 2011 go rish 2019, Ajimobi kolet senate fom for eleshion but e lost di eleshion.Ajimobi kpai on 25 of June 2020, an na COVID-19 sikness kos am.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Isiaka Abiola Adeyemi Ajimobi for December 16, 1949 Insaid di Ajimobi famili of Ibadan for Oja-Iba, Ibadan. Isiaka Abiola Adeyemi Ajimobi stat e edukashion for Saint Patricks Primary School, Oke-Padre for Ibadan an e finish primari skul for Ibadan City Council Primary School, Aperin. E du e sekondri skul for Lagelu Grammar School. Ajimobi waka go du univasiti edukashion for United States of America, wey e rid Business Administration and Finance for State University of New York, insaid Buffalo city for New York. E kolet Bachelor of Science degree satifiket for di Univasiti. Afta dat, Ajimobi go du MBA for Operations Research and Marketing as e put eye for Finance in Governors State University, University Park, for di city of Illinois inside di United States of America.

How e tek du politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2003, Isiaka Abiola Adeyemi Ajimobi bikom Senator for Naija an e post for senate na Deputy Minority leader of the Senate. In 2007, Ajimobi kontest an lose di gofnor eleshion wit di parti All Nigeria Peoples Party. Ajimobi kontest again wit di parti Action Congress of Nigeria an dis time e win in 2011.

Pipul no Ajimobi as sombodi wey plan how Oyo Stet go tek fine wel wel.Evribodi no Ajimobi as fada of Oyo Stet. Wen Ajimobi win di sekond eleshion in April 11, 2015 as gofnor of Oyo Stet, dis mek am di fest pesin to du gofnor bak to bak in Oyo Stet. For June 16, 2020, Di National Working Committee(NWC) of APC for dia mitin chuz Ajimobi as di aktin National Chairmanof di All Progressives Congress (APC).

How e tek dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

On June 19 2020, dem Rosh Ajimobi go one hospitu for Lagos Stet wey dem dey kol First Cardiologist and Cardiovascular Consultants Hospital afta COVID-19 mek am dey Koma. Ajimobi kpai on June 25, 2020.Ajimobi wife Florence Ajimobi an e five pikin stil dey for life wen e kpai.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]