Seyi Makinde

From Wikipedia

Oluseyi Abiodun Makinde (dem bon am for 25 December 1967) be Naija businessman, politician plus including philanthropist who be di Governor of Oyo State inside Naija since 29 May, 2019 .Him be engineer wey dey gbaski and get correct experience for wetin dem dey call fluid and gas metering. Na him be di oga kpatakpata for Makon Group Limited wey be local oil and Gas Company for inside Nigeria. Oluseyi Makinde been start his first oil and gas business wey him call Makon Engineering and Technical Services, (METS) when him be 29years of age for year 1997, after him don get correct correct work experience when him dey work with international oil and gas companies. Makinde bin contest and lose di 2015 Oyo State gubernatorial election on top the platform of Social Democratic Party (SDP) .

How e take start[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Oluseyi Makinde inside di family of one correct teacher wey later becom accountant, late Pa Olatubosun Makinde and Madam Abigail Makinde for Aigbofa Compound inside Oja’ba for Ibadan. Na him be di third pikin inside di family. Makinde bin start primary school for St Paul Primary School come finish am for St Michael Primary School, Yemetu, Ibadan. Him do secondary school for Bishop Phillips Academy, Monatan, Ibadan. For 1985, him get admission to University of Lagos (Unilag) dat na where e get di certificate wey dem call bachelor's degree for Electrical Engineering.

For 1998, Oluwaseyi waka go Industrial Control Services inside Houston, Texas go get correct training on top wetin dem call Safety Shutdown System; come join Development of Analytical Competence for Managing Operations for Lagos Business School (now Pan-Atlantic University)in 1999. For year 2000, he bin get training for another area wey dem call automation. For year 2002, him waka go study wetin dem call Fundamentals of Crude Sampling for Jiskoot Auto Control Training Centre,inside Kent, England. Again for year 2005, Oluseyi Makinde waka go study Understanding and Solving Complex Business Problems for Massachusetts Institute of Technology (MIT), inside USA.

How im take work and do business[chenj-am | chenj-am for orijin]

Makinde bin do national service (NYSC) for Shell Petroleum Development Company (SPDC) Nigeria, where dem later give am work as pupil engineer. Him serve for different capacities come handle and join hands on top several key projects between 1990 and 1992. Him bin work as field Engineer (Eket operations) for Rebold International Limited from 1992 to 199 where dem later make am Field Manager in 1995. For inside year 1997, Makinde start his first business, Makon Engineering and Technical Services Limited (METS), after him don work for five years (1992-1997) with many international oil and gas companies (IOCs), as Engineering Manager. Na him come be the oga kpatakpata for Makon Group of Companies. Makinde be member of many correct national and international professional bodies wey include: Nigerian Society of Engineers (NSE), Council for Regulations of Engineering in Nigeria (COREN), Oil and Gas Design Engineers of Nigeria (OGDEN), International Society of Automation (ISA), Institute of Measurement and Control UK; and American Measurement Institute (AMI).

How im take do politics[chenj-am | chenj-am for orijin]

For year 2007, Makinde bin contest and lose election for the Oyo South Senatorial seat on top the platform of the All Nigeria Peoples Party (ANPP) to People's Democratic Party candidate- Kamoru Adedibu. Makinde no allow that loss to shake am as him come try try contest in 2010 under the People's Democratic Party, PDP for Oyo South 2011 Senatorial seat but lose inside primary to the Senator wey bin dey represent Oyo South. For year 2014, Makinde make up him mind to fight for Oyo State 2015 governorship ticket on top the platform of the People's Democratic Party (PDP) but for December 2014 when dem finish party's primary election,dem no gree give am the governorship nomination ticket. Na this mata plus to achieve his ambition make Oluseyi makinde waka comot for People's Democratic Party PDP) go join Social Democratic Party (SDP), where him contest for governor of Oyo State in year 2015. For September 2017,after many talk talk with the Caretaker National Chairman of PDP, Senator Ahmed Makarfi wey come visit am for Ibadan plus including many many meetings National Leaders, Oyo State leaders plus elders of the Social Democratic Party for inside Oyo State, Engineer Seyi Makinde return to his before before political party, People's Democratic Party (PDP) where him talk say him no return for personal gain but na becos him wan join contribute to the development of the state. For September 29, 2018, Makinde comot as People's Democratic Party (PDP) candidate wey go contest for the governorship election for 2019 general elections for Oyo State, after him get polling 2772 votes at the primary election that took place at liberty stadium, Oke-Ado in Ibadan.

Mr. Seyi Makinde was elected into the Office of the Governor of Oyo State for inside the Gubernatorial elections for Oyo State wey dem do on March 9, 2019 after him get 515,621 votes come take defeat his rival, Mr Adebayo Adelabu of the All Progressive Party wey get 357,982 votes.

Di award wey im collect[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Nigerian Union of Journalists (Oyo State Council)-Laudable Contribution to Humanity Merit Award.
  • National Association of Oke-Ogun Students (Ibadan)-Merit Award.
  • Fiditi Grammar School (Oyo State)-Old Student Merit Award in appreciation to the commitment, dedication and service to the association and humanity.
  • Junior Chamber International (JCI) University of Calabar Chapter.-Entrepreneurial Excellence Award.
  • Sports Writers Association of Nigeria (Oyo State Chapter)-Gold Merit Award for immense and invaluable contribution to sports development.
  • Nigerian Association of Social Workers Merit Awards (Oyo State Chapter)-Philanthropic gestures and contribution to Social Care Delivery Services.
  • CCII National Merit Award.
  • Federal Radio Corporation of Nigeria (Ibadan) - awarded Seyi "Astute Politician of the Year 2018" for his resilience with which he had continued to assist the less privileged in the society.

Im personal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oluwaseyi dey live for Ibadan inside Oyo State. Him dey married to Tamunominini Makinde and dem get three children.