Abayomi Barber

From Wikipedia
Abayomi Barber
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAbayomi Chenj-am
Famili nemBarber Chenj-am
Wen dem bon am23 October 1928 Chenj-am
Ples wey dem bon amIle Ife Chenj-am
Wen e kpai26 December 2021 Chenj-am
PapaSamuel Chenj-am
MamaVictoria Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duartist, profeso Chenj-am
Wu e dey wok forUniversity of Lagos Chenj-am
Wie e go skulCentral School of Art and Design, Yaba College of Technology Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Abayomi Adebayo Barber (dem bon am for October 23, 1928 an e dai for December 26, 2021) na Naija pesin wey dey draw fain fain tins for Naijá an e bi di oga for Barber Art School wey dey insaid Legos for Naija. E get koneshion wel wel for insaid Naijá muzik but plenti oyibo pipul no sabi am. Dem rili sabi am as pesin wey biliv sey evritin wey dey hapun for dis laif jost dey hapun an dem sabi am as pesin wey biliv sey dream dey hapun.Barber don rait som tins abaut di foma presido for Naija wey di nem na Murtala Mohammed an anoda pesin wey don bi Oba for Ile-Ife bifor wey im nem na Adesoji Aderemi. One of e wok wey pipul sabi wel wel na di one wey im yuz oil pent tek draw Shehu Shagari.

How im tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Barber for October 23, 1928 for Ile-Ife for Samuel Bamidele an Victoria Waleola Barber famili. Na for St Peter's Anglican School e tek stat im skul mata for Iremo wey dey inside Ife an na for 1948 im finish im skul for St Stephen's Skul for inside Modakeke for Ife. For 1949, Barber yuz stik du one fain tin an im kom du plenti kompitishon for insaid dat year. Na for 1952 pipu stat to sabi am for Legos wen im win one kompitishon wey Elder Dempster dey du wey di nem na Lines Silver Cup bikos na im win am as di pesin wey di tin wey im draw fain pas for di Nigeria Festival of the Arts. Afta dem giv am di prize, dem kom tel am to draw di oga kpata-kpata for Ikoyi klub wey wan stop to bi di oga kpata-kpata wey im nem na Harold Cooper. Dem giv Barber wok for Legos wen 1952 jost dey stat as pesin wey dey draw for buk an for pipul wey wan mek evribodi sabi wetin dem dey sel for one Naijá Kompini for Yaba insaid Legos. For 1955, Barber join one pipul wey de yuz stone do fain-fain tins for Yaba College of Technology wey di oga kpata-kpata na one man wey kom from Britain wey im nem na Paul Mount. For 1957, one of Barber papa broda wey e nem na Adesoji Aderemi kari am go mit Awolowo wey bi di oga kpata-kpata for Westa Naijá. Bikos of dis one, e kom join di pipul wey dey du plenti-plenti tins to see if dem go sabi as di Yoruba pipul tek stat.Barber wok as pesin wey bi dey folo pesin du plenti tins an dis one mek am see plenti big-big pipul laik Saburi Biobaku, William Fagg, Frank Willet an Dr Bradburty. For 1960 go rish 1962 di Govament kari am go Central School of Arts and Crafts for London. For dis skul, Barber len how to kip tins mek dem no spoil an e kom stil kontiniu di wok wey dem yuz stone tek mek Obafemi Awolowo. Wahala kom hapun for insaid di Govament wey kom mek govament stop to dey pay for im skul. As im dey for England e kontiniu to dey len how to dey draw, e len how dem dey yuz stone mek fain fain tins for Mancini an Tozer studios wey dey inside London. Barber stil wok as di pesin wey folo di oga kpata-kpata for one studio wey Edward Delaney get an e kom stil wok for Oscar Nemon Studio for St James Studio for London.Barber wok wit Nemon to yuz stone do five difren difren fain design of Winston Churchill. Na im stil bi di sekond oga for di ples wey dem kip plenti tins wey don tey for laif for Britain. Na for 1971 e kom bak to Naijá an dem giv am wok as pesin we dey draw for insaid School of African And Asian Studies wey di nem now na Center for Cultural Studies for University of Lagos. Dem kom tel am to draw di pesin we dey rul for Ethopia wey im nem na Haile Selassie for di taim wen e kom Naijá. Wen Barber kom bak to Naijá, e no laik di way dem dey tek draw for hie bikos im biliv sey if pesin kontiniu to dey draw evritaim, di pesin go rili sabi di wok wel-wel.Barber stat to dey tich pipul di wok for 1973 an na Muri Adejim im fest tich for inside di yunivasiti.

Na for 1989 Barber fest sho plenti pipul im wok an e kol am Abayomi Barber A Retrospective. Som of im wok stil dey for insaid National Gallery of Modern Art laik di one wey im yuz stone design Ali Maigoro an Yemoja.

Barber kontiniu to dey draw fain fain tins wit pent an stone an for one buk insaid midu of 2017 e tok abaut im wok an wetin im biliv for laif.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]