Wale Edun

From Wikipedia
Olawale Edun
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija, Ogun State Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, banker Chenj-am

Olawale Edun na Naija pesin wey dey stodi bizness, banka, an di niu Naija Minista of Finans.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wale Edun go Yunivasiti of London go rid Ekonomik. Di Yunivasiti give am B.Sc in Ekonomik. E leta go do e Masta digree in Yunivasiti of Sussex

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 1980-1986

From 1980 to rish 1986, Edun wok for "Chase Merchant Bank" ( di bank leta bikom Continental Bank). For September 1986, Edun join di Wold Bank with one program kol "Elite Young Professional Program". For Wold Bank, e wok helep on Ekonomik an fanashiha pakeji for plenti kontri wey dey Latin America an di Karebi-an.

  • 1989

For 1989, Edun join bodi with odas tek fom "Investment Banking & Trust Company Limited" (di Bank nem now na Stanbic IBTC). Edun wok for di Bank ana Ezekutiv Daretor.

  • 1994

Edun form "Denham Management Limited" as e don dey wok as dia Chairman sins March 2008.

How e tek do politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Naija presidet Bola Tinubu stil bi di govnor of Legos Stet, e chuz Wale Edun as Komishonal of finans for Legos Stet. Na Edun do komishonal from 1999 go rish 2004. Na Wale Edun bi di chairmanof di govinin kansu an di board of trustee of di Trust Fund for di "Hydrocarbon Pollution Remediation Project" (HYPREP). Dey form HYPREP to fit kari out di plan wey UNEP (United Nations Environmental Report) get for Ogoniland.

In 2023, Naija presidet Bola Tinubu chuz am as di Minista of Stet, Health an Soshal Welfare. Na 21 August 2023 e start di wok.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wale Edun na board memba of di Nigerian Chairman of di Duke of Edinburgh International Award Foundation. E na di chairman of Legos Boxing Hall of Fame, one hoganazeshon wey dey sopot boxing for Legos. Wale Edun bi di Chairman of "Livewell Initiative, one NGO hoganazeshon wey dey into sport.