Tunde Ednut

From Wikipedia
Tunde Ednut
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemTunde Chenj-am
Famili nemAdekunle Chenj-am
Wen dem bon am20 January 1986 Chenj-am
Ples wey dem bon amKatsina Chenj-am
Broda an sista4 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician, influencer, entertainer, blogger, comedian Chenj-am
Pat of wok wey e put mindblogger Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos Chenj-am
Academic majorgraphics Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
RilijonBaptists Chenj-am
Eye kolorblack Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
KontriNaija Chenj-am

Tunde Olaoluwa Adekunle (dem bon am on 20 January 1986), wey plenti pipu sabi as Tunde Ednut, na Naija blogger, Komedian, e dey du musik an meni pipu sabi am wit songs lik Jingle Bell an Catching Cold, wey dey insaid songs wey fit win Headies award for bes pop single at di Headies Awards of 2013. Pipu sabi am as pesin wey dey du wel for blogging.

In 2021, na Ednut bi di pesin wey dem find pas for Net Honours Class 2001. Dat sem year dem, Ynaija kol am pawafu Naija yung pesin.

How e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fom Kogi Stet, but dem bon am for Katsina to Naija lecturers, wia e tek gro as Christian bifor im famili kom Legos Stet. E stodi Graphic arts for Universiti of Lagos. Leta e kon go UK to get digre for Graphic design fom Kingsland Universiti of London.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

2007 - 2008 : Wen e stat

Ednut fest stat as komedian insaid 2007, wia e tek pafom for Dynamix Awods wey dey du for Nigeria. In 2008, im nem dey insaid pipu wey fit win Di Future Awords Afrika. Sem year, E pafom for plenti shos in Naija an United Kingdom. Na Ednut win bes Naija komedian aword wey dey UK bifor e kom Naija to stat musik wok. 2011 - til nau

Ednut stat musik wok in 2011 wit im fest song wey bi "My Kind Song". In 2012, e rilis "Catching Cold" wit remix wit Dr SID. In 2014, e rilis 3 songs wey bi "Baby Boo", "Buga Won" an "Kosowo". In 2016, e rilis "Jingle Bell" wey get plenti remix wit oda Naija stars, Mi Abaga, Davido, Tiwa Savage an Seun Kuti.

Oda tins wey e dey du[chenj-am | chenj-am for orijin]

No bi onli blogging an musik e dey du, e dey hep an sopot oda komedian an singas, e dey sho dem for im Instagram pej. Pipu no am as pesin wey hep komedian an singas lik: Ugocie, Aloma Isaac Junior, Sydney Talker an Kiriku.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. "Kiriku writes Tunde Ednuts pours out his mind". The Guardian (Nigeria), 19 November 2023. Retrieved 11 January 2024.

2. "I've been crazy since I was a kid - Sydney talker". The Punch, 2 March 2019. Retrieved December 29 2023.