Sule Lamido

From Wikipedia
Sule Lamido
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejSule Lamido Chenj-am
Wen dem bon am30 August 1948 Chenj-am
Ples wey dem bon amBirnin Kudu Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Hausa langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, diplomat Chenj-am
Post wey e deyMinister of Foreign Affairs, Governor of Jigawa State Chenj-am
Wie e go skulGovernment College, Birnin Kudu, Barewa College Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
E pipulHausa pipul Chenj-am

Sule Lamido (dem bon am on 30 August 1948) na Naija politishan wey sarf as govnor of Jigawa Stet fom 2007 rish 2015. Na im bi di bifor bifor foreign Affairs Minister of Nigeria fom 1999 rish 2003. Na People's Democratic Party (PDP) memba e bi.

Insaid 2015 e dey on trial bikos of di kain way e tek du moni enihau by EFCC.

Hau e tek stat wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Lamido on 30 August 1948 insaid Bamania, Birnin Kudu Lokal Govmet Aria of Jigawa Stet Nigeria.

Lamido enta politis as memba of People's Redemption Party (PRP) insaid Nigerian Sekond Repoblik. Wia plenti pipu no lik di wey e tek du for June 12, 1993 genera eleshon, wen Moshod Abiola, wan enta ofis.

Wen pesin wey bi president onda militiri dey rul, General Sabi Abacha tok dey e wan go democracy bak, Lamido dey insaid pipu wey stat Social Progressive Party. An na im stil bi di Nashonal Secretary of di niu party. Dem put am for prison insaid 1998 bikos e dey tok bad tins abaut Abacha plan of ofis. Afta Abacha kpai in June 1998, General Abdulsalami Abubakar anous niu way wey dem go dey du tins, wey kon mek niu party dey for 1999 eleshon. Lamido kon bi memba of People's Democratic Party (PDP). E trai enta as govnor of Jigawa Stet in 1999 eleshon wen Nigerian Fourth Repoblik dey stat, e no enta bikos Ibrahim Saminu Turaki of All People's Party (APP) win am.

Foreign Minista[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na President Olusegun Obasanjo mek Lamido Foreign Minista in June 1999, wey mek katakata hapun wit Abubakar Remi wey dey tink sey na im dem go giv.