Siminalaya Fubura

From Wikipedia
Siminalaya Fubura
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am28 January 1975 Chenj-am
Ples wey dem bon amOpobo Chenj-am
Fest langwejIjaw Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Ijaw Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, accountant Chenj-am
Wu e dey wok forRivers State government Chenj-am
Post wey e deyGovernor of Rivers State Chenj-am
Wie e go skulRivers State University of Science and Technology, University of Port Harcourt Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
E pipulIjaw people Chenj-am
RilijonChristianity Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am

Amaopusenibo Siminalayi "Sim" Joseph Fubara ( dey bon 28 January 1975) na Naija pesin wey bi di govno of Riva Stet. Sim Fubura don fest work as Akauntant Jeneral of Riva Stet.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Opobo Town wey de Opodo/Nkoro Loka Govamet Aria of Riva Stet. E go Opodo Pamari Skul an e finish Komprehesive Sekondri Skul Opodo. Sim Fubura rid Akauntin at di Riva Stet Yunivasiti of Sayensi an Teknoloji. Na Yunivasiti of Pot Hakut e tek get e MBA satifiket in 2013. E kolet e Msc satifiket from di sem Yunivasiti in 2016.

Projet wey e sahin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sim Fubura as di govno of Riva Stet sahin #195.3 billion naira kontat with Julius Berger mek dey yuz am do Pot Hakut Ring Road Projet. Wen dem go finish di road, di road go pass six Loka Govamet Aria of di Stet. Dis one go helep mek plenti pipo no tu de Pot Hakut siti an dis one fit mek di siti free smol. Di Govno tok sey di Stet go fest give Julius Berger 150 billion Naira mek dem tek start .

How e tek work[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sim Fubura start e karia in 2003 as akauntant with Riva Stet Sinior Sekondri Skul Board.

In 2015, e bikom di daretor of finans an akaunt at di Stet Govamet House. In March 2020, e bikom pamanet sekretiri of Riva Stet. Sim Fubura bikom di Akauntin Jeneral of Riva Stet on 23 December 2020 an e do e work go rish May 2022. E stop to bi di Akauntin Jeneral of Riva Stet bikos e don win di pamari eleshon wey PDP (People's Democratic Party|Pipo Demokrati Parti]] do for dia 2023 Jeneral Eleshon. Sim Fubura na memba of Nigeria Institute of Manijimet. E stil bi memba of Hassosiashon of Nashonal Akauntin of Nigeria.

Bad tins wey pipo tok sey e do[chenj-am | chenj-am for orijin]

For May 2012, EFCC Ekonomik an Finanshial Krime Kommishon kol Sim Fubura an 58 odas govamet ofishal for how dey tek yuz 435 billion Naira.

Dem stil wan mek e wan tok wetin hapun to di 117 billion Naira wey im an four oda Riva Stet Govamet ofishal.

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sim Fubura papa nem na Joseph Fubura an e mama nem na Love Fubura. E papa na forma souja wey go get trenin for Oyinbo land. Sim Fubura wife na Valerie Fubura an di marej produs three pikin.